Nigerian Pidgin Bible
Acts 20
1 Afta di wahala for Efisos, Pol send for di disaipols and afta e enkorage dem, e tel dem bye-bye kon komot der go Masidonia.
2 Afta e waka roun di aria, e enkorage di bilivas wey dey der kon go Greece.
3 E stay for der for tiri monts. Bikos Ju pipol don plan to wait mak dem kash am, as e won enta ship go Syria, e kon go bak tru Masidonia.
4 Pipol wey folo Pol go, na Sopater, wey bi Frius pikin wey kom from Berea; Aristakus and Sekondus wey kom from Tesalonika; Gaius from Derbe; Timoti wit Tikikus and Trofimus wey kom from Asia.
5 All dis pipol don go for front go wait us for Troas.
6 Wi enta ship from Filipai afta di Passova Fist and afta faiv days, wi mit dem for Troas kon stay der for sevun days.
7 For di first day for di wik, wen wi hol mitin to break bread togeda, Pol kon start to tok wit di pipol and bikos e won go di next day, e kon prish til mid-nite.
8 (For di room for upstair wer wi for dey mit, lamp meni for der),
9 won boy wey dem dey kol Eutikus, sidan for di window kon dey slip as Pol dey prish. Di slip kari am go, so e fal from di tiri storey and wen dem rush go kari am, dem si sey e don die.
10 Bot Pol go dan, laidan on-top di boy, kon put en hand roun am sey, "Mak una nor wori, bikos e stil dey alaif!"
11 Den Pol go upstair and afta e don break bread wit dem, e folo dem tok til day break. Den e kon komot from der.
12 Dem tak di boy go haus kon dey hapi sey e dey alaif.
13 Wi waka go wer di ship dey kon go Assos, so dat wi go kari Pol for der, bikos e plan sey e go pas land go der.
14 Wen e mit us for Assos, wi kari am for di ship kon go Mitilene.
15 From der, wi move and di next day, wi kon rish Miletus.
16 Pol don sey e go travol pas Efisos mak e for nor spend taim for Asia, bikos e dey hurri mak e for kwik rish Jerusalem for Pentecost Day.
17 From Miletus, e send mesanga go Efisos sey mak di eldas wey dey di shosh kon mit am der.
18 Wen dem kom, e tel dem, "All of una no haw I dey liv my life since di taim wey I dey wit una and from di first day wey I enta Asia,
19 haw I nor dey kari bodi up as I dey serv Jisos wit pain and wahala wey I dey face, bikos of wiked plan wey Ju pipol get for mi.
20 "Una no sey I nor stop to dey tel una enitin wey go help una and I tish una for publik and for una haus.
21 "I dey prish giv Ju and Greek pipol sey mak dem turn from sin kom mit and serv God and put dia fate for awa Oga Jisos Kraist.
22 "Naw, di Spirit dey lid mi go Jerusalem, ivun doh I nor no wetin go hapun to mi for der,
23 esept sey di Holi Spirit dey warn mi sey, from tawn to tawn, na prizin and sofa dey wait for mi.
24 "Bot I nor kount my life to min enitin, so dat I go fit finish my wok and di ministri wey I risiv from Jisos Kraist, wey bi to prish abaut di Gud News wey go mak pipol undastand God grace.
25 "Naw, I no sey non of una wey I prish God kindom giv, go si mi again.
26 "So, I won tel una naw sey, nobodi blood dey for my head.
27 "Bikos I nor hide enitin from una, as I dey tel una abaut God plan.
28 "Mak una tak kare of unasef and all di pipol wey di Holi Spirit don put unda una, bikos na una bi di lidas for God shosh, wey E buy wit en onli pikin blood.
29 "I no sey afta I don go, wiked pipol wit bad maind go kom join una. Pipol wey nor go sori for di ship.
30 "Ivun among una, som men go stand dey tish lai-lai tins kon draw pipol folo bodi.
31 "So mak una shine una eye and rimemba sey, for day and nite for tiri years, I nor stop to dey krai, as I dey warn una.
32 "Naw, I liv una for God hand, so mak en wod wey get grace, kip una. Dis wod wey get grace fit mak una grow and get share wit all God pipol.
33 "Since una no mi, I nor put eye for enibodi gold, silva or koat.
34 "Una no sey na dis my hand I tak dey wok and get evritin wey I wont and ivun dey help pipol wey dey wit mi.
35 "Laik dis, I don show una sey wi must help oda pipol wey wik and una rimemba wetin Jisos Kraist tok, wen e sey, 'E beta mak pesin dey giv pipol tins, dan mak e dey kolet from dem.'"
36 Wen e tok all dis tins finish, e nil dan wit all of dem kon pray.
37 All of dem start to krai, as dem draw Pol near bodi kon dey kiss am.
38 Wetin Pol tok kon mak dem wik, bikos e sey, "Una nor go si mi again." So dem folo am go rish wer di ship dey.