Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Titus 3

1 Mak yu rimaind di bilivas sey, mak dem respet doz wey dey rule dem. Dem must obey and dey redi to du gud.

2 Mak dem nor eva tok bad abaut enibodi, insted mak dem dey liv for peace, dey gentol and dey bihav wel to evribodi.

3 Bifor naw, wi dey bihav laik fool; wi nor dey obey; wi dey disiv pipol; wi bi savant to tins wey dey swit us; wi dey du bad tins and dey jelos odas; pipol hate us and wi hate dem tu.

4 Bot wen God awa Savior show us di kiandnes and luv wey E get for us,

5 E kon save us. Nor bi bikos wi du gud, bot na bikos of en mesi. E forgiv awa sins and E mak us new shildren kon giv us new life tru di Holi Spirit.

6 God giv us dis Spirit for fri tru Jisos Kraist wey bi awa Savior.

7 Since Kraist grace don mak us klin for God eye, wi don bi pipol wey dey wait for di life wey nor go end and wi dey sure sey, wi go get am.

8 Dis wod wey I dey tok so na trut and I wont mak yu mak sure sey evribodi wey trust God dey du gud. Dis tishin dey gud and e go help evribodi.

9 Nor put mout for wod wey nor mak sense: laik mata wey konsan hu born hu and kworel or fite abaut Ju pipol law. All dis tin dey yuzles and dem nor min enitin.

10 If enibodi dey won kause kworel for di shosh and yu don warn am rish tu taims and e nor gri shange, den mak yu driv am.

11 Bikos dat kaind pesin don turn from di trut and en own sin go kondem am.

12 If I send Artemas or Tikikus kom mit yu, mak yu trai kom mit mi for Nikopolis, bikos I don diside sey, na der I go stay ontil kold season go end.

13 Mak yu du evritin wey yu fit du to help Zenas, wey bi lawya and Apollos for dia joni and mak sure sey dem get evritin wey dem nid.

14 Laik dis tu, awa pipol go learn haw to du gud and help pipol wey rili nid help. And as dem dey du laik dis, dem nor go liv yuzles life.

15 Evribodi wey dey wit mi dey grit yu! Mak yu grit all di pipol wey luv us. Mak God grace dey wit all of una.

Open Bible reader