Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Romans 14

1 Mak una dey welkom God pipol. Ivun doh dia fate nor tu strong, mak una nor kos dem, bikos of wetin dem dey tink sey dey gud or bad.

2 Som pipol tink sey e dey rite to chop eni fud and odas wey dia fate dey wik, dey chop onli vegetabol.

3 Since God dey welkom evribodi, mak una nor kondem odas bikos dem chop or dem nor chop wetin una laik.

4 Wish rite yu get to kondem anoda pesin savant? Na onli dia oga fit tok weda dem dey du wel and e must mak sure sey, dem dey du di rite tin.

5 Som pipol tink sey won day beta pas anoda and som tink sey, evriday na di same. Bot mak evribodi biliv wetin dem won biliv.

6 Enibodi wey tink sey won day beta pas anoda, dey du so to onor God. And enibodi wey chop meat, dey tank God jos laik di pesin wey nor won chop.

7 Nobodi dey liv or die for ensef. Weda wi die or wi liv, na God stil get us.

8 If wi liv, na God wi dey liv for; if wi die, na God wi stil die for. So, weda wi die or wi liv, na God stil get us.

9 Dis na bikos Kraist die and e kom bak to life, so dat e go bi Oga to pipol wey don die and doz wey dey alaif.

10 Bot why yu dey kondem oda Kristains? Why yu dey si dem as smol shildren? Di day dey kom wen God go joj all of us.

11 God wod sey, "Weda dem laik am or not, evribodi go nil dan for my front kon sey na mi bi God."

12 So, all of us go tel God wetin wi du wit awa life.

13 So, mak wi nor dey joj won anoda and mak wi nor spoil anoda pesin fate.

14 As I don no Kraist, e don mak mi no sey all fud dey klin. Bot if yu tink sey e nor gud mak yu chop som fud, dat nor min sey, e nor gud for anoda pesin.

15 Bikos if di fud wey yu chop mak yor broda or sista ves for yu, den yu nor dey show luv again. So mak yu nor let di kaind fud wey yu dey chop, offend di pesin wey Jisos Kraist die for.

16 Nor let pipol kos Jisos Kraist, bikos of di fud wey yu dey chop.

17 Bikos God kindom nor bi fud and drink mata, bot na abaut raitiousnes, peace and joy wey di Holi Spirit dey giv pipol.

18 If yu serv Kraist laik dis, God go dey hapi wit yu and pipol go respet yu.

19 So, mak wi liv for peace, den wi go help ish oda grow as dem dey serv God.

20 Nor skata God wok bikos of fud. Evri fud dey okay, bot e nor gud mak yu chop wetin go spoil anoda pesin fate.

21 E beta mak yu nor chop meat, drink wine or du enitin wey fit spoil yor brodas fate.

22 Enitin wey yu biliv abaut dis mata, mak yu kip am to yorsef and God wey dey hevun, dey si-am. God don bless di pesin wey nor kondem ensef, bikos of wetin e du.

23 Bot if yu dey doubt wetin yu chop, den yu dey kondem yorsef and yu no sey dat nor gud, bikos enitin wey yu du against wetin yu biliv, na sin.

Open Bible reader