Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 92

1 Na good thing e be to give thanks to you, O LORD, and to sing honor you, O Most High God,

2 to dey talk about your constant love every morning and your faithfulness every night,

3 with music of string instrument and with melody on the harp.

4 O LORD, your mighty work dey make me happy; because of wetin you don do, I dey sing for joy.

5 Your actions na great action, LORD; Wetin you dey think dey deep!

6 This na something wey foolish person no fit know; person wey dey stupid no fit understand.

7 the wicked fit grow like weed, those wey do wrong fit prosper; yet dem go destroy totally,

8 because you, O LORD, you be Almighty forever.

9 We know say our enemy go die, and defeat go swallow the wicked.

10 You don make me strong like wild ox; you don bless me with happiness.

11 I don see as you defeat my enemy and I don hear as the wicked dey cry.

12 The righteous go flourish like palm tree; dem go grow like cedar of Lebanon:

13 Dem be like tree wey dem plant for house of the LORD, wey dey flourish inside the Temple of our God,

14 wey still dey commot fruit for old age and e dey green and strong always.

15 This show say the LORD dey do good, and say my protector no get any wrong.

Open Bible reader