Nigerian Pidgin Bible
Psalms 84
1 LORD Almighty, I love your Temple,
2 I go like dey there; I dey long to dey for LORD Temple. With my whole life I dey sing for joy to the living God.
3 Even the sparrow don build nest, and the swallows get their own house; dem dey keep their young one near your altar, LORD Almighty, my king and my God.
4 I know say those wey dey for you Temple na happy people, dem always dey sing praise to you.
5 Those wey there strength come from you na happy people, wey dey eager to travel go Mount Zion.
6 As dem dey pass through the dry valley of Baca, e turn to place of spring; the autumn rain full am like pool.
7 Dem grow strong as dem dey go; dem go see the God of gods on top Zion.
8 Make you hear my prayer, LORD God Almighty. Hear me, O God of Jacob;
9 Bless our king, O God, the king wey you don choose.
10 One day for your Temple pass thousand days anywhere else; I go rather stand for gate of God house pass make I dey live for house of the wicked.
11 Na the LORD be our protector and glorious king, wey dey bless us with kindness and honor. Him no dey refuse anything good to those wey dey do wetin dey right.
12 LORD Almighty, those wey trust you na happy people.