Nigerian Pidgin Bible
Psalms 70
1 O God, come save me! LORD, help me now!
2 Defeat and confuse those wey dey try kill me. All those wey dey happy because I dey for trouble make dem turn back and make shame catch them.
3 Shock those wey dey make fun of me as you defeat them.
4 Make everybody wey come to you dey happy. Make everybody wey dey thank you for your salvation dey always talk say, God na great God!
5 I dey weak and poor; come meet me quick, O God. You be my savior and my LORD - hurry come help me.