Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 55

1 Hear my prayer, O God; no turn away as I dey beg you.

2 Hear wetin I dey talk and make you answer me; I don worn out because I dey worry.

3 I dey fear as my enemy dey threaten me, I don weak as the wicked dey oppress me. Dem bring trouble on top me; dem dey vex with me and dem hate me

4 I dey fear, and the fear of death dey make me weak.

5 Fear catch me and I dey shake; fear don overcome me.

6 I wish say I been get wing like dove. I for fly away go find rest.

7 I go fly far away and I go build house for desert.

8 I go hurry find shelter for myself from the terrible wind and storm.

9 O Lord, confuse wetin my enemy dey talk; I dey see riot and violence for the city,

10 wey dey surround am day and night, wey be say na crime and trouble full am.

11 Destruction dey for everywhere; oppression and fraud full the street.

12 If to say na enemy dey laugh me, I fit endure am; if to say na opponent dey boast for me, I fit hide myself from him.

13 But na you, my partner, my teammate and close friend.

14 We been get deep talk with each other and worship together for Temple.

15 Make my enemy die before their time; make dem go down alive inside world of the dead; evil dey their house and e dey their heart.

16 But I call to the LORD God for help and him go save me.

17 Morning, afternoon and night my complain dey go up to him, and him go hear my voice.

18 Him go bring me back safe from the battle wey I dey fight against plenty enemy.

19 God, wey don rule from eternity, go hear me and him go defeat them; because dem no gree change, and dem no dey fear him.

20 My former partner attack him friend; him break him promise

21 Him words smooth pass cream, but evil dey for him heart; him word dey gentle like oil, but e dey cut like sharp sword.

22 Make una leave una trouble with God, and he go defend una; he no dey allow defeat come to honest people.

23 But O God, na you go bring those killers and liars to their grave before half of their life finish. As for me, I go trust in you.

Open Bible reader