Nigerian Pidgin Bible
Psalms 47
1 Make una clap una hand for joy, all people; Make una praise God with loud song!
2 Una must fear the LORD, the Most High; na him be the great king, wey dey rule the world.
3 Him give us victory over the people; na him make us rule over the nation.
4 Na him chose the land wey we dey live for us, the possession of him people wey him love.
5 God dey go up to him throne. Dem dey shout for joy and dem dey blast trumpet as the LORD dey go up.
6 Make una sing praise to God; sing praise give our king
7 God na king on top all the world; praise him with song
8 God dey sit for him holy throne; him dey rule over the nations.
9 Na him be ruler of nations wey gather together with the people of the God of Abraham, him dey powerful pass plenty army; he dey rule over everything.