Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 45

1 Beautiful word full my mind, as I write this song for the king. Like the pen of good writer, my tongue dey ready with poem.

2 Na you fine pass from all the men; you be fluent speaker. God dey always bless you.

3 Make you hold your sword well, mighty king; you dey glorious and majestic.

4 Make you ride on in majesty to victory to go defend truth and justice; your strength go win great victories!

5 Your arrow dey sharp, e dey go through the heart of enemy; nations dey fall down for your feet.

6 The kingdom wey God don give you go last forever and ever. You dey rule on top your people with justice;

7 you like wetin dey right and you hate evil. Na why the LORD, your God, don chose you and him don pour out happiness on top you pass any other king.

8 The perfume of myrrh and aloes dey for your cloth; musician dey entertain you for palace wey dem decorate with ivory.

9 Daughter of kings dey among the women wey dey for your house, and for the right side of your throne be the queen wey wear ornament of finest gold.

10 King bride, make you hear wetin I wan talk - make una forget una people and family.

11 Your beauty go make the king dey want you; him na your master, so make you obey him.

12 People wey dey Tyre go bring you gift; rich people go try win your favor.

13 The princess dey for palace - she beautiful; Na gold thread dem use make her gown.

14 Dem lead am go meet king inside her gown wey dey colorful, and her bridesmaid follow her.

15 With joy and gladness dem enter the king palace.

16 My king, you go get plenty son to succeed your ancestor as king, and you go make them rulers on top all the earth.

17 My song go keep your fame alive forever, and everyone go praise you for all time to come.

Open Bible reader