Nigerian Pidgin Bible
Psalms 39
1 I talk say, I go dey careful about wetin I dey do and I no go allow my tongue make me sin; I no go talk anything when evil people dey near.
2 I been dey quiet, I no even say one word, I no even talk anything good; but my suffer just dey increase join,
3 And worry take over me. The more I dey think, the more my trouble dey increase; I no fit stop to dey ask say:
4 LORD, how long I go still live? When I go die? Tell me how soon my life go end.
5 You don make my life short! For your eye my lifetime be like nothing. For sure, every living being no pass puff of wind to you,
6 Dem no pass shadow. All we dey do na nothing; we dey gather wealth, but we no know who go collect am.
7 God, wetin I fit come dey hope for? I put my hope in you.
8 Make you save me from my sin, no allow fools laugh at me.
9 I go keep quiet and I no go talk one word, because na you make me suffer like this.
10 No punish me again; your blow don almost kill me already.
11 You dey punish our sin by condemning us, and you dey destroy wetin we love like moth. For sure, we no pass puff of wind to you!
12 God, make you hear my prayer and hear as I dey cry; come rescue me as I dey cry. Just like all my ancestor, I be your guest for a while.
13 Make you leave me alone make I get happiness small before I commot and no dey alive again.