Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 3

1 God, I get plenty enemy, plenty people don turn against me,

2 Dem talk about me say, God no go help me”

3 But O LORD, na you be my shield from danger always; na you give me victory and bring back my courage.

4 I dey call to the LORD for help, and him dey answer me from him holy hill.

5 I lie down sleep, and the LORD protect me for all night.

6 I no dey fear thousands of enemies wey surround me for every side.

7 Come, LORD: Save me, my God, you go punish all my enemy and you no go allow them get power to wound me.

8 Na from the LORD victory dey come from – make he bless him people.

Open Bible reader