Nigerian Pidgin Bible
Psalms 29
1 Praise the LORD, una wey dey heaven; praise him glory and power.
2 Praise the glorious name of God; When the Holy one show, make una bow down.
3 On top the sea, dem dey hear the LORD voice; the glorious thunder from God, and him voice dey echo on top ocean.
4 Dem hear the voice of God in all him majesty and might.
5 The voice of the LORD break the cedars, even the cedars of Lebanon.
6 He dey make mountains of Lebanon dey jump like calf and he dey make mount Hermon waka like young bull.
7 The voice of the LORD dey make lightning flash.
8 Him voice dey make desert dey shake; he dey shake desert of Kadesh.
9 The LORD voice dey shake the oaks and he dey commot leaf from tree and everyone wey dey the temple dey shout say, Glory to GOD!
10 Na God dey rule over deep water; he go rule as king forever.
11 God dey give strength to him people and he dey bless them with peace.