Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 22

1 My God, My God, why you don abandon me? I don cry seriously for help, but e no dey come.

2 For day time I call on you, my God, but you no dey answer; I call for night, but I get no rest.

3 But na you be king as the Holy one, the one wey Israel dey praise.

4 Our forefathers been put their trust in you; dem trust you, and you save them.

5 Dem call on you and dem escape from danger; dem trust you and dem no dey disappointed.

6 But I no be human being again; I be worm, wey everybody dislike and wey dem dey mock.

7 Everybody wey see me dey mock me; dem dey commot their tongue and shake their head.

8 Dem dey talk say, “You dey rely on the LORD. Why him no save you? If the LORD like you, why him no dey help you?’’

9 Na you deliver me safely when dem born me, when I be pikin, you keep me safe.

10 I don rely on you since when den born me, and na you don always be my God.

11 Make you no stay away from me; trouble dey near, and nobody dey to help me.

11 Plenty enemy dey surround me like bull; dem dey around me, like strong bull wey dey Bashan land.

12 Dem dey open their mouth like lion, dem dey shout at me.

13 My strength don go, e don go like water wey drop for ground. All my bone don commot from the joint; my heart be like candle wey don melt.

14 My throat dey dry like dust, and tongue don gum the roof of my mouth. You don leave me to die inside dust.

15 Evil group dey around me; like plenty dog dey attack me; dem dey tear my hand and feet.

16 Dem fit see all my bone. My enemy dey look me and dem dey look me with terrible eye.

17 Dem carry my cloth bet and share am with each other.

18 O LORD, no stay away from me! Come rescue me quickly!

20 Save me from the sword; make you save my life from these dogs.

21 Make u rescue me from these lions; I dey helpless for front of this terrible bull.

22 I go tell my people wetin you don do; I go praise you for their gathering:

23 “Praise him, una wey be servant of the LORD; Honor him, una descendants Jacob. Worship him, una people of Israel.”

24 He no dey abandon the poor or make he ignore as dem dey suffer; him no dey turn away from them, but he dey answer when dem dey call for help.’’

25 For the full gathering I go praise you for wetin you don do; for the midst of people wey dey worship you I go offer sacrifice wey I promise.

26 The poor go chop as dem want; those wey come to the LORD go praise him. Dem go prosper forever!

27 All nation go remember the LORD. From every part of the world dem go turn to him; all kind people go worship him;

28 The LORD na king, na him dey rule the nation.

29 All the people wey dey proud go bow down to him; all ordinary person go bow down before him.

30 Future generation go serve him; dem go speak about the LORD to generation wey dey come.

31 Dem go tell people wey dem never born now say: “God save him people.”

Open Bible reader