Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 18

1 How I take love you, LORD; you be my defender.

2 The LORD na my protector, he be my strong tower. My God na my protection, and I dey safe with him. He dey protect me like shield; he dey defend me and e dey keep me safe.

3 I dey call the LORD, and he dey save me from my enemies. Praise the LORD!

4 The danger of death dey around me; the wave of destruction dey roll over me.

5 The danger of death dey around me, and the grave dey set hin trap for me.

6 Inside my trouble I dey call to the LORD; I call God for help. He hear my voice for him temple; he hear as I dey cry for help.

7 The earth con shake; the foundation of the mountain shake too, because God dey vex.

8 Smoke commot from him nose, fire wey fit kill and coal wey dey burn come from him mouth.

9 He tear the sky and come down with dark cloud under him feet.

10 He fly fast on top creature wey get wing; he travel on top wind wing.

11 He cover him body with darkness; thick cloud wey get plenty water dey surround him.

12 Hailstone and flashes of fire come like lightning before him and he break through the dark cloud.

13 God con talk with vex from the sky; and dem hear the voice of the Most High.

14 He con shoot him arrow and scatter him enemy; with flash of lightning dem start to dey run.

15 God, when you dey condemn your enemy, and as you dey shout for them as you dey vex, the ground of the ocean con dey naked to eye, and the earth foundation con dey open.

16 God send him hand down from above and he take me for hand; he con pull me commot from the deep water.

17 He rescue me from my powerful enemy and from those wey hate me - dem dey too strong for me.

18 When I dey inside trouble, dem attack me, but God protect me.

19 He dey help me out of danger; he save me because he dey happy with me.

20 The LORD dey bless me because I dey do wetin dey right; he dey bless me because I dey innocent.

21 I don obey the law of the LORD; I never turn away from my God.

22 I don check all him law; I never disobey him commands.

23 He know say I no get fault, and say I don keep myself from doing wetin dey wrong.

24 So he dey reward me because I do wetin dey right, because he know say I dey innocent.

25 O LORD, you dey faithful to those wey dey faithful to you; you dey good to those wey dey perfect.

26 You dey pure to those wey dey pure, but you dey vex for those wey dey wicked.

27 You dey save those wey dey humble, but u dey humble those wey get pride.

28 O LORD, you give me light; you drive away my darkness.

29 You dey give me power to attack my enemy and power to use overcome their defense.

30 This God – things wey you dey do na perfect things; person fit trust him word! He be like shield for all those wey ask for him protection.

31 The LORD alone na God; God alone na our defense.

32 Na him be God wey dey make me strong, wey dey make my way safe.

33 He dey make my feet strong like deer; he dey keep me safe on top mountain.

34 He dey train me for battle, so that I go fit use the bow wey strong pass.

35 O LORD, you dey protect me and you dey save me; I con dey great because you care, and your power don keep me safe.

36 You don keep me so that dem no go fit catch me, and I never fall before.

37 I dey pursue my enemy and I dey catch dem; I no dey stop until I destroy them.

38 I dey strike them down, and dem no fit stand again; dem lie for ground as I don defeat them.

39 You dey give me strength for battle and victory over my enemy.

40 Na you make my enemy dey run from me; I dey destroy those wey hate me.

41 Dem cry for help, but nobody save dem; dem dey call to the LORD, but he no answer them.

42 I crush them, so that dem go turn like dust wey wind blow commot. I match on top dem like mud wey dey road.

43 You dey save me from people wey dey cause riot and you make me ruler over nation; people wey I no know con turn my concern.

44 Foreign people dey bow to me; when dem hear me , dem dey obey.

45 Dem dey lose courage and dem con dey shake from their strong tower.

46 The LORD dey alive! Praise my defender! I dey hail the greatness of God who dey save me.

47 He dey give me victory over my enemy; he dey quiet nations under me.

48 and he dey save me from my enemy. O LORD, you dey give me victory over my enemy and you dey protect me from violent people.

49 Na so I come praise you among the nation; I dey sing praise to you.

50 God dey give victory to him king; he dey show love every time to the person wey him chose, to David and the people wey follow am.

Open Bible reader