Nigerian Pidgin Bible
Psalms 17
1 O LORD, hear as I dey beg for justice; hear the way I dey cry for help, listen to my prayer wey dey honest.
2 You go judge in my favor, because you know wetin dey right.
3 You know as my heart be. You don come meet me for night; you don check me well and you no see any evil inside me.
4 I no talk evil as others dey do; I don obey your command and I never follow violent way.
5 I dey always waka for your way and I never leave am.
6 I dey pray to you, O God, because you dey answer me; so make you turn to me and listen to wetin I dey talk.
7 Show your love and save me; for your side I dey safe from enemy.
8 Protect me as you go do to your own eyes; hide me under your wing shadow
9 from wicked people attack. Deadly enemy dey surround me;
10 dem no get pity and dem dey talk with pride.
11 Dem dey around me now, anywhere wey I turn, dem dey watch for time wey dem go pull me down.
12 Dem be like lions, wey dey wait for me, wey wan tear me to pieces.
13 O LORD, make you come against my enemy and defeat them; use your sword save me from the wicked;
14 save me from those wey get all dem want in this life. Punish them with suffer wey you don keep for them; make some remain for there children.
15 But I go see you, because I never do anything wrong; and when I wake, your presence go fill me with joy.