Nigerian Pidgin Bible
Psalms 144
1 Praise the LORD, my protector! He dey train me for battle and he dey prepare me for war.
2 Na him be my protector and defender, my shelter and savior, I get my trust in him. He dey defeat nation wey dey under me.
3 LORD, why people dey important to you? Dem be ordinary person. Why you dey pay attention to them?
4 Dem be like small wind wey blow commot; their days be like shadow wey just dey pass.
5 0 LORD, make you tear sky and come down; touch mountain and dem go pour out smoke.
6 Send flash of lightning and scatter your enemy; shoot them your arrow make dem run commot.
7 Come down from above, commot me from deep water, and save me; save me from power of foreigners,
8 wey no dey talk true and wey dey use lie swear.
9 I go sing new song give you, O God; I go play harp and sing to you.
10 You dey give victory to king and you dey save your servant David.
11 Save me from wicked enemy; save me from power of foreigner, wey no dey ever talk true and wey dey use lie swear.
12 Make our sons grow like plant wey dey grow up strong when dem dey for youth. Make our daughter dey like glorious pillars wey decorate corners of palace.
13 Make different kind plenty crop full our barn. Make all the sheep wey dey our field born plenty in tens of thousands.
14 Make our cattle born plenty and make none of them get any loss. Make cry of pain no dey our street.
15 E go dey wonderful to have that kind blessings! Yes, those wey get the LORD as their God go dey happy.