Nigerian Pidgin Bible
Psalms 143
1 LORD, hear my prayer! Hear me as I dey beg in your righteousness; answer me in your faithfulness
2 No put me your servant for trial; nobody dey innocent for your eye.
3 My enemy don hunt me down and dem don defeat me finish. Dem don put me for dark prison, and I be like those wey don die for long time ago.
4 So I don ready to give up; I dey for deep pain.
5 I remember days wey don pass; I think of things you don do, I remember all good things wey you don do.
6 I lift my hand make I pray to you; my soul dey hungry for you like dry ground dey hungry for water.
7 Answer me now, LORD! I don lose hope. No hide yourself from me or I go dey among those wey go enter world of the dead.
8 Remind me of your constant love every morning, because I dey put my trust in you. My prayer dey go up to you; show me way I suppose go.
9 I dey come meet you for protection, LORD; save me from my enemy.
10 You be my God; teach me to dey do wetin you want. Dey good to me, and guide me for safe way.
11 LORD, save me as you don promise; make you save me from my trouble in your good way!
12 Because of your love for me, kill my enemy and destroy those we dey suffer me, because I be your servant.