Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 141

1 I dey call you, LORD; make you come help me now; make you hear me when I call you.

2 Receive my prayer as incense, receive my hand wey I lift as evening sacrifice.

3 LORD, control my mouth, put guard for door of my lips.

4 Keep me so that I no go wan dey do wrong and keep me make I no join evil people for the wicked things wey dem dey do. Make I no take part in their feast.

5 Good people fit punish me and condemn me, but I no go ever take honor from evil people, because I always dey pray against evil work.

6 When dem throw their leader down from high rock, the people go gree say my word na true.

7 Like wood wey don split and scatter to pieces, naso their bone go scatter for edge of their grave.

8 But I go continue dey trust you, my sovereign LORD. I dey find your protection; no let me die;

9 Protect me from trap wey dem set for me, from the work of those evildoers.

10 Make the wicked fall inside their own trap, as I dey pass without harm.

Open Bible reader