Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 122

1 I dey happy when dem tell me say, “Make we go to house of God.”

2 And now we dey here, as we dey stand inside gate of Jerusalem!

3 Na new Jerusalem be this! Dem don rebuild the city and e dey beautiful and get unity.

4 Na where tribes of Israel dey come give thanks to the LORD be this, according to him command.

5 Na for here kings of Israel go siddon judge their people.

6 Make una pray for peace of Jerusalem: “Make those wey love una prosper.

7 Make peace dey inside una wall and make una palace dey safe.’’

8 Because of my relative and friend, I tell Jerusalem say, peace go dey with una!

9 Because of the house of the LORD our God, I pray say good things go happen to this city.

Open Bible reader