Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 119

1 Those wey dey live without fault na happy people, those wey dey live according to the law of the LORD.

2 Those people wey follow him command na happy people, those wey dey obey him with all their heart.

3 Dem no dey do wrong; dem dey work in the way of the LORD.

4 LORD, you don give us your law and you tell us make we dey obey them faithfully.

5 I hope say I go dey faithful to dey keep your instructions!

6 If I dey careful of your command, then shame no go catch me.

7 As I dey learn your righteous judgement, I go praise you with pure heart.

8 I go obey your law; make you no abandon me!

9 How young people fit keep their lives pure? Na to dey obey your command.

10 With all my heart I dey try serve you; keep me make I no disobey your commandment.

11 I dey keep your law for my heart, so that I no go sin against you.

12 I praise you, O LORD; make you teach me your way.

13 All the law wey you don give me, I go talk am again loud.

14 I dey happy to dey follow your command, pass make I dey rich.

15 I dey study your command; I dey study your teachings.

16 I dey enjoy your law; I no go forget your command.

17 I be your servant, dey good to me, so that I fit live and obey wetin you dey teach me.

18 Open my eyes so that I go fit see the wonderful truth wey dey your teachings.

19 I dey here on top earth for just little time; no hide your command from me.

20 My heart dey pain and e dey hungry; I wan know your judgment for all time.

21 You dey punish the proud; you dey curse those wey disobey your command.

22 Free me from their insult and bad-belle, because I don keep your law.

23 The ruler meet and dem make plan against me, but I go study your teaching.

24 Your command dey give me joy; dem be my advisers.

25 I dey lie down inside dust as dem don defeat me; save me as you don promise.

26 I confess everything wey I don do, and you answer me; make you teach me your ways.

27 Help me so that I go fit understand your law; and I go think about your wonderful teaching.

28 Sorrow don take over me; give me strength as you don promise .

29 Keep me make I no go the wrong way, and teach me your law in your goodness.

30 I don choose to dey obey; I don pay attention to your judgment.

31 I don follow your instruction, LORD; no let shame catch me.

32 I go obey your command quick, because you go give me better understanding.

33 LORD, teach me wetin your law mean, and I go obey am every time.

34 Explain wetin your law mean to me, and I go obey am; I go keep am with all my heart.

35 Keep me to dey obey your commandments, because I dey get happiness inside am.

36 Give me desire to dey obey your laws instead of make I dey rich.

37 Keep me make I no dey get time for useless things; dey good to me as you don promise.

38 Keep your promise to me wey be your servant - the promise wey you make to those wey dey obey you.

39 Save me from insult wey I dey fear; your judgment na wonderful judgement!

40 I wan obey your command; give me new life, because you dey righteous.

41 LORD, show me how much you love me, and save me as you don promise.

42 Then I go fit answer those wey dey insult me because I trust your word.

43 Allow me make I dey talk true every time, because my hope dey for your judgment.

44 I go obey your law, forever and ever.

45 I go live in freedom wey dey perfect, because I dey try obey your teaching.

46 I go announce your command give kings and shame no go catch me.

47 I dey find joy to dey obey your command; because I love them.

48 I dey respect and love your commandment; I go think about your instructions.

49 Remember your promise to me your servant; e don give me hope.

50 Even as I dey suffer I get comfort because your promise give me life.

51 The proud dey disrespect me always, but I never leave your law.

52 I remember your judgment wey don tey, and dem dey give me comfort, O LORD.

53 When I see the wicked dey break your law, I dey always vex.

54 When I dey live for earth, I write songs about your command.

55 LORD, I dey remember you for night, and I dey think about your law.

56 I dey get my happiness when I dey obey your command.

57 Na only you I want, O LORD; I promise say I go obey your laws.

58 I dey ask you with all my heart make you have mercy on me, as you don promise!

59 I don consider as I dey behave, and I promise to dey follow your command.

60 Without delay I dey hurry to dey obey your command.

61 The wicked don set trap for me, but I no dey forget your law.

62 For middle of night I dey wake to praise you for your righteous judgment.

63 I be friend to everybody wey dey serve you, and those wey dey obey your law.

64 LORD, the earth dey full of your constant love; teach me your commandment.

65 LORD, you don keep your promise, and you dey good to me wey be your servant.

66 Give me wisdom and knowledge, because I get trust in your command.

67 I been dey do wrong thing before, and you punish me, but now I dey obey your word.

68 You be good and kind God! Teach me your command.

69 Proud people don lie about me, but I go obey your command with all my heart.

70 Dem no get understanding, but I dey enjoy your law.

71 My punishment dey good for me, because e make me learn your command.

72 The law wey you give dey important to me pass all the money wey dey this world.

73 You create me, and you keep me safe; give me understanding, so that I fit learn your law.

74 Those wey dey honor you go dey happy when dem see me, because I get trust in your promise.

75 LORD, I know say your judgment dey righteous, and say you punish me because you dey faithful.

76 Make your love comfort me, as you don promise me, your servant.

77 Have mercy on me, and I go live because I dey enjoy your law.

78 Make shame catch the proud as dem dey use lie accuse me; as for me, I go think about your instructions.

79 Make those wey honor you come meet me - all those wey know your command.

80 Make I obey your command perfectly and make you no allow shame catch me.

81 LORD, I don tire as I dey wait for you to save me; I dey put my trust in your word.

82 My eye don tire to dey watch wetin you promise, as I dey ask say, “When you go help me?”

83 I dey useless like wineskin wey dem reject; yet I never forget your command.

84 How long I go still wait? When you go punish those wey dey suffer me?

85 The proud wey no dey obey your command, don dig pit to catch me.

86 Na all your commandment I trust; people dey lie to suffer me - help me

87 Dem don almost succeed to kill me, but I never ignore your command.

88 Because of your constant love, treat me well, so that I go obey your law.

89 O LORD, your word go last forever; na everlasting e be for heaven.

90 Your faithfulness dey for all time; you don put the earth for him place, and e remain for there.

91 Na your command make all thing remain today, because all of them na your servant.

92 If your law no be the source of my joy, I for don suffer die.

93 I no go ignore your instruction, because na with them you don keep me alive

94 I be your own- save me; I don try obey your command

95 The wicked dey wait to kill me, but I go meditate on your laws.

96 I don learn say everything get limit; but your command dey perfect.

97 I love your law! I dey think about am all day.

98 Your commandment dey with me every time and e dey make me wise pass my enemy.

99 I dey understand pass all my teachers, because I dey think about your instructions.

100 I get better wisdom pass those wey don old, because I dey obey your command.

101 I don run commot from all evil behavior, because I wan obey your word.

102 I never ignore your command, because you be my teacher.

103 The taste of your command sweet pass honey!

104 I dey gain wisdom from your law, and so I dey hate bad behavior.

105 Your word be like lamp wey dey guide me and light for my way.

106 I go keep my honest promise to obey your good instruction.

107 LORD, my suffer dey terrible; keep me alive, as you don promise.

108 O LORD, make you accept my prayer of thanks and teach me your command.

109 I dey always dey ready to risk my life; I never forget your law.

110 The wicked set trap for me, but I never disobey your command.

111 Your commandment na my own forever; dem be the joy of my heart.

112 I don decide make I obey your law until the day wey I go die.

113 I hate those wey no dey completely loyal to you, but I love your law.

114 You be my defender and protector; I put my hope for your promise.

115 Una wey dey sin, make una commot for my side. I go obey God command.

116 Give me strength as you don promise, and I go live; no disappoint my hope.

117 Hold me, and I go dey safe, and I go always pay attention to your command.

118 You reject everybody wey disobey your law; na useless thing e be as dem dey deceive.

119 You treat the wicked like rubbish, so I love your command.

120 Because of you I dey fear; fear catch me because of your judgment.

121 I don do wetin dey right and good; no abandon me give my enemy!

122 Promise say you go help your servant; no let strong-head people suffer me!

123 My eye don tire as I dey watch for your help wey dey save, and for the deliverance wey you promise.

124 Treat me in the way of your constant love, and make you teach me your command.

125 I be your servant; make you give me understanding, so that I fit know your teaching.

126 LORD, e don reach time make you act, because people dey disobey your law.

127 I love your command pass gold, pass gold wey fine well.

128 And so I dey follow your instruction; I hate all wrong way.

129 Your teaching dey wonderful; I dey obey them with all my heart.

130 As you dey explain your teaching e dey give light and e dey bring wisdom to people wey no sabi.

131 My desire for your command strong so tey I dey wait with my mouth open.

132 Turn to me make you have mercy on me as you dey do all those wey love you.

133 As you don promise, keep me make I no fall; no allow evil overcome me.

134 Save me from those wey dey suffer me, so that I go fit obey your command.

135 Use your presence bless me and teach me your law.

136 My cry dey pour down like river, because people no dey obey your law.

137 LORD, you dey righteous, and your law dey good.

138 The rule wey you don give dey good and right completely.

139 My anger dey burn inside me like fire, because my enemy no dey take your command serious.

140 Na your promise sure pass! I love am!

141 I no dey important and people hate me, but I no dey ignore wetin you dey teach me.

142 Your righteousness go last forever, and your law na true always.

143 Na trouble and worry full me, but your commandment dey bring me joy.

144 Your command dey always dey good; make you give me understanding and I go live.

145 With all my heart I dey call you; answer me LORD, and I go obey your command

146 I dey call on you; save me, and I go keep your law.

147 Before sunrise I dey call you for help; I dey put my hope in your promise.

148 I dey awake all night, I dey think about your command.

149 Because your love dey constant, make you hear me, O LORD; show your mercy, and keep my life!

150 My wicked persecutor dey come close, those people wey no dey keep your law.

151 But you dey near to me, LORD, and all your command dey permanent.

152 E don tey wey I don learn about your command; you make them last forever.

153 Look as I dey suffer, make you save me, because I never reject your law.

154 Defend my plan and set me free; save me as you don promise.

155 The wicked no go dey safe, because dem no dey obey your law.

156 But your love dey great, LORD; show your mercy and save me

157 I get plenty enemy and oppressor, but I no dey fail to obey your law.

158 When I look those traitor, dem dey make me vex, because dem no dey keep your command.

159 See as I love your command, LORD; your love no dey change, so save me!

160 The heart of your law na true, and all your righteous judgment go last forever.

161 Powerful people dey attack me in bad way, but I dey respect your law.

162 I dey very happy because of your promise, like person wey see treasure wey dey happy.

163 I hate lies, but I love your law.

164 I dey thank you seven times every day, for your righteous judgment.

165 Those wey love your law get perfect security, and nothing fit make them fall.

166 I dey wait make you save me, LORD, and I dey do wetin you command.

167 I dey obey your teaching; I love them with all my heart.

168 I dey obey your instruction and command; you dey see everything wey I dey do.

169 As I dey cry for help, make e reach you, LORD; give me understanding as you don promise.

170 Listen to my prayer, and save me as you don promise.

171 I go dey praise you always, because you don teach me your law.

172 I go sing about your law, because your command na good one.

173 Make you always dey ready to help me, because I dey follow your command.

174 I dey hungry for your help, O LORD; I dey get happiness in your law.

175 Give me life so that I fit praise you; make your instruction help me.

176 I dey waka around like sheep wey lost; so come find me, your servant, because I never ignore your laws.

Open Bible reader