Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 115

1 O LORD, na to you alone, and no be to us, suppose dey get glory, because of your love wey no dey change and faithfulness.

2 Why nations go dey ask us say, “Where una God dey?”

3 Our God dey for heaven; he dey do anything wey him like.

4 Na silver and gold dem use make their god, dem use their own hand form am.

5 Dem get mouth, but dem no fit talk, and dem get eyes, but dem no fit see.

6 Dem get ear, but dem no fit hear, and dem get nose but dem no fit smell.

7 Dem get hand, but dem no dey feel, and dem get feet, but no fit waka; dem no fit make any sound.

8 Make those wey make them and trust in them be like the idols wey dem don make.

9 Una wey dey for Israel, make una trust in the LORD. He dey help una and protect una.

10 Make una priest of God trust in the LORD. He dey help una and protect una.

11 All of una wey dey worship him, make una trust in the LORD. He dey help una and protect una.

12 God dey remember us and he go bless us; he go bless the people of Israel and all priest of God.

13 Him go bless everybody wey honor him, the big and small the same way.

14 God go give una pikin - una and una descendants!

15 The LORD wey make heaven and earth go bless una!

16 Na only the LORD get heaven, but him give us wey be human the earth.

17 Dead people no fit praise the LORD. Those wey dey inside grave no dey praise the LORD.

18 But we go give thanks to him now and forever! Praise the LORD!

Open Bible reader