Nigerian Pidgin Bible
Psalms 108
1 O God, I get complete confidence! I go sing and praise you! My soul, make you wake up!
2 My harp and lyre, make una wake up! I go wake up the sun.
3 O LORD, I go thank you among the people, and I go praise you among nations.
4 Your love wey no dey change high pass heaven; and your faithfulness dey touch skies.
5 O God, show your greatness for sky, and show your glory on top all the earth.
6 Use your power save us; answer my prayer, so that the people wey you love go dey safe.
7 God don talk from him sanctuary say, In victory I go share Shechem and Sukkoth Valley to my people.
8 Gilead na my own, and Manasseh too; Ephraim na my helmet and Judah na my royal staff.
9 But I go use Moab as my wash bowl, and I go throway my sandal on top Edom, as sign say na me get am. I go shout victory over Philistines.
10 O God, who go take me enter the strong city? Who go lead me go Edom?
11 Shey you don really reject us? You no go march out with your army?
12 Help us against the enemy; human help dey useless.
13 We go win with God on our side; him go defeat our enemy.