Nigerian Pidgin Bible
Psalms 103
1 Praise the LORD, my soul! Everything wey I be, praise him holy name!
2 Praise the LORD, my soul, and make you no forget how kind him be.
3 Na him dey forgive all my sins and heal all my disease.
4 He dey keep me from grave and he bless me with love and mercy.
5 He been full my life with good things, so that I go stay young and strong like eagle.
6 The LORD dey judge to favor those wey dey oppressed and give them wetin belong to them.
7 He been show him plan to Moses and allow the people of Israel see him mighty work.
8 The LORD dey merciful and loving, he dey slow to dey vex and he dey full of love every time.
9 He no dey continue to dey punish; he no dey vex forever.
10 Him no dey punish us as we suppose get or pay us back the way we dey sin and do wrong things.
11 As high as the sky dey above the earth, naso him love dey great for those wey honor him.
12 As far as the east dey far from the west, naso him dey take commot our sin from us.
13 As father dey kind to him children, naso the LORD dey kind to those wey honor him.
14 Him know wetin we be; him remember say we be dust.
15 As for us, our life be like grass. We grow and flourish like wild flower;
16 the wind con blow on am, e don blow commot- nobody see am again.
17 But for those wey dey honor the LORD, him love dey last forever, and him goodness dey for all generations
18 of those wey dey true to him covenant and wey dey obey him command faithfully.
19 The LORD put him throne for heaven; na him be king on top all.
20 Praise the LORD, una strong and mighty angels, wey dey obey him command, wey dey hear wetin him talk.
21 Praise the LORD, una heavenly power, una wey be him servant, wey dey do him will!
22 Praise the LORD, everything wey him create for all place wey him dey rule. Praise the LORD, my soul!