Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Proverbs 5

1 My pikin, make you pay attention, and listen to my wisdom and understanding.

2 Then you go know how to dey behave very well, and your words go show say you get knowledge.

3 Lips of another man wife fit dey sweet like honey and her kisses fit dey smooth like olive oil,

4 But when e don finish, she no go leave you anything wey pass bitterness and pain.

5 She go take you down to world of the dead; the road wey she dey waka na the road to death.

6 She no dey stay for the road to life; but she dey waka around, and she no know wetin dey happen.

7 My pikin, now make una listen to me, and no forget wetin I dey say.

8 Make una stay away from that kind woman! No even go near her door!

9 If una con go, na others go gain the respect wey una don get before, and una go die young for the hand of people wey no get mercy.

10 Yes, strangers go take all una wealth, and wetin una don work for go become another person own.

11 At last, una go dey sad, una flesh and muscles go destroy,

12 And una go talk say, “Why I no go ever learn? Why I no allow anybody correct me?

13 I no listen to my teachers. I no pay attention to them.

14 And I con see say shame don catch me for public.”

15 Make you dey faithful to your own wife and give your love to her alone.

16 Pikin wey you get by another women no go do you any good.

17 Your pikin suppose grow up to help you, no be strangers.

18 So make you dey happy with your wife and find your joy with the woman wey you marry-

19 Woman wey dey pretty and graceful like deer. Allow her charm dey keep you happy, and allow her surround you with her love.

20 My pikin, why you go give your love to another woman? Why you go prefer the charm of another man wife?

21 God dey see everything wey you do. Anywhere you go, he dey watch.

22 Na trap the sins of the wicked be. Na the net of their own sins don catch them.

23 Dem die because dem no get self-control. Stupid things wey dem talk go send them to their graves.

Open Bible reader