Nigerian Pidgin Bible
Proverbs 17
1 E better make you chop dry bread with peace of mind pass make you chop for house wey dey full of trouble.
2 A wise servant go gain authority over him master stupid pikin and he go receive part of the inheritance.
3 Na fire dem dey use make gold and silver pure, and na God dey make person heart pure.
4 Evil people dey listen to evil ideas, and liars dey listen to lies.
5 If you dey laugh poor people, na God wey make them you dey insult. If you dey take pleasure in someone trouble, you go be punished.
6 Grandparents dey get pride in their grandchildren, as children dey get pride in their parents.
7 Person wey people respect no dey lie, and stupid people no get anything useful to talk.
8 Some people dey think say bribe dey work like magic; dem believe say e fit do anything.
9 If you want make people like you, make you forgive them when dem do you wrong. To dey remember wrong fit break up a friendship.
10 Intelligent person dey learn from one correction pass fool wey dey learn from hundred times of beating.
11 Death go come like evil messenger to wicked people wey dey always cause trouble.
12 E better make you meet a bear wey dem thief her pikin pass make you meet some fools wey dey busy with stupid things.
13 If you use evil pay good, evil no go commot from your house.
14 The start of an argument na like first break of dam; stop am before e go turn something else.
15 To dey condemn the innocent or allow the wicked go free - the two na wetin God hate.
16 E no do fool any good to dey spend money on education, because he no get sense.
17 Friends dey always show their love. Wetin una be relative for, if no be to share trouble?
18 Na only someone wey no get sense go promise to dey responsible for another person debts
19 Troublemakers love to dey start arguments. Anybody wey like to brag dey find trouble.
20 Anyone wey think and talk evil no fit expect to find anything good- na only disaster.
21 Na shame go catch a man wey get stupid pikin. Stupid pikin no fit bring joy to him father.
22 Happiness na good medicine, but sorrow na disease.
23 Corrupt judges dey accept secret bribes, and dem no dey do justice.
24 Intelligent person dey aim at wise action, but fool dey start off for many directions.
25 Foolish children dey bring sorrow and bitter regret to their papa and mama.
26 No be right thing to dey punish innocent or attack leaders because dem dey do right thing.
27 People wey dey sure of themselves no dey talk all the time. People wey dey stay calm dey get real understanding.
28 When a fool keep him mouth shut, people dey think say he wise: people dey see person wey dey calm as a man wey get understanding.