Nigerian Pidgin Bible
Philemon 1
1 Na Pol, wey bi prizina bikos of Jisos Kraist and awa broda Timoti rite dis leta to Filemon, awa dear broda and co-woka.
2 And to Afia awa sista, Arkippus awa felow soja and di shosh wey dey mit for en haus.
3 Mak God and awa Oga Jisos Kraist giv una grace and peace.
4 Evritaim wey I rimemba yu for my prayas, I dey tank my God,
5 bikos I don hear abaut di fate and luv wey yu get for awa Oga Jisos Kraist and all God pipol,
6 so I dey pray sey di fate wey yu get go mak yu undastand all di blessins wey bi yor own insaid Kraist.
7 I get joy and my heart dey strong bikos of yor luv and tru yu, all God pipol heart don strong tu.
8 Since I get strong biliv for Kraist sey, I fit tel yu mak yu du wetin dey rite,
9 mi, Pol, wey bi old man and prizina bikos of Kraist, won advise yu wit luv.
10 I beg, mak yu dey kaind to Onesimus, wey bi my pikin for God wok and e dey prizin wit mi.
11 Bifor, e nor dey yuzful to yu, bot naw, e dey yuzful to mi and yu.
12 I dey send am kom bak kom mit yu (ivun-doh I luv am wel-wel).
13 If to sey yu dey here, I for wont mak e help mi as I stil dey prizin bikos of di gospol wok.
14 Bot I nor won du enitin wey yu nor go laik, so dat di gud wey yu du, nor go bi by fos, bot e go kom from yor maind.
15 May bi na bikos of dis mak am nor dey wit yu since, bot naw, e go dey wit yu foreva.
16 Nor bi as slave, bot as broda wey wi luv, bikos e don big pas slave. E don bikom awa broda naw, bikos God don shange am.
17 So, if yu si mi as yor broda and patina, mak yu asept am as yu go tak asept mi.
18 If e tif or hol yu enitin bifor, mak yu tel mi and I go pay.
19 Na mi Pol tak my hand rite dis leta sey, I go pay bak, bot I fit stil sey, yu yorsef dey hol mi.
20 So my broda, mak yu du dis tin for mi bikos of Kraist, so dat bele go swit mi.
21 I dey sure sey yu go du wetin I ask yu, so I dey rite giv yu, bikos I no sey yu go du pas wetin I ask.
22 So, mak yu priper wer I go stay, bikos I no sey yor prayas go mak dem fri mi kom mit yu soon.
23 Epafras, wey dey prizin wit mi, bikos of Jisos Kraist, dey grit yu.
24 Mark, Aristakus, Demas and Luke, wey bi my co-wokas, dey grit yu tu.
25 Mak awa Oga Jisos Kraist grace dey wit yor spirit.