Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Numbers 4

1 God tell Moses

2 make he count men wey dey Levite family of Kohath family group,

3 and register all men between age thirty and fifty wey fit work for Tabernacle Tent.

4 Their work na to dey take care of most holy things.

5 God give Moses the instructions wey follow. When time don reach to break camp, Aaron and him son go enter the Tent, take down the curtain wey dey for front of Covenant Box, and use am cove the Box.

6 Dem go put a fine leather cover on am, spread blue cloth on top am, and put the poles wey dem go use carry am.

7 Dem go spread blue cloth on top the table wey dey use offer bread to God, and make dem put the plates, spoon, incense bowl, offering bowl, and cup wey dem dey use for wine offering on top the table. Make bread dey always dey on top the table.

8 Dem go spread red cloth on top them, put fine leather cover on top am, and put pole to use carry am.

9 Dem go take blue cloth and use am cover the lampstand, with the lamps, tongs, trays, and all the olive oil container.

10 Dem go wrap am and all the equipment inside fine leather cover and place am on top a frame wey dem go use am.

11 Make dem spread blue cloth on top the gold altar, put a fine leather cover on top am, and put poles wey dem go use carry am.

12 Make dem gather all the things wey dem dey use for worship for Holy Place, wrap them in blue cloth, put a fine leather cover on top am, and put them on a frame to use carry them.

13 Dem go remove the greasy ashes from the altar and spread purple cloth on top am.

14 Dem go gather all equipment wey dem use for worship for altar and put them on top altar: firepans, hooks, shovels, and basins. Dem go put a fine leather cover on top am, and put poles to use carry am.

15 When time don reach to break camp, the Kohath family group go come carry only the holy things after Aaron and him sons don finish to dey cover them and their equipment. Make the Kohath family no touch the holy things, or dem go die. Na the work of Kohath family anytime dem dey move Holy Tent be this.

16 Na Eleazar, son of Aaron the priest go dey in charge of the Holy Tent and the oils for lamps, the incense, the grain offerings, the anointing oil, and all other things wey dem don dedicate to God inside the Holy Tent.

17 God tell Moses and Aaron,

18 “No allow Kohath family die

19 when dem come near the most holy things. Make Aaron and him sons go give each man him task and tell him wetin to carry.

20 But if Kohath family enter Tent and see the priests as dem dey prepare the holy things wey dem go move, dem go die.”

21 God tell Moses

22 make he count Levite tribe of Gershon by sun-tribe and family group,

23 and register all men wey dey between age thirty to fifty wey fit work for Tabernacle Tent.

24 Na to dey carry the objects wey follow be their duty:

25 the Holy Tent, the inner cover, the outer cover, the fine leather cover on top am, the curtain for the entrance,

26 the curtain and rope for the court wey dey round the Tent and altar, the curtain for entrance of the court, and all the fittings wey dem use set up all these things. Na dem go do all the task wey dem need do these things.

27 Moses and Aaron go make sure say the Gershonites do their work and carry everything wey Aaron and him son don give them to do.

28 Na the work of Gershon family group inside Tent be this; dem go carry them out under direction of Ithamar, son of Aaron the priest.

29 God tell Moses make he count Levite tribe of Merari by family and family group,

30 and make he register all the men between age thirty and fifty wey fit work for Tabernacle Tent.

31 na them go dey carry frames, bars, posts, bases of the Tent,

32 and the posts, bases, pegs, and ropes of the court round the Tent, with all fittings wey dem dey use set them up. Each man go dey carry wetin dem ask am to carry.

33 na the work of Merari family group for the Tent be this: dem go carry am out under direction of Ithamar, son of Aaron the priest.

34 Moses, Aaron, and Israelite leaders count the Kohathites by family and family group.

35 Dem count all the men from 30 to 50 years old wey fit serve. Dem give them special work to dey do for Tabernacle Tent.

36 Na 2,750 men for Kohath family group qualify to do this work.

37 Naso dem give these men from Kohath family group their special work to dey do for the Tabernacle. Moses and Aaron do wetin God don tell Moses to do.

38 Dem count Gershonite family group too.

39 Dem count all the men from 30 to 50 years old wey qualify to serve. Dem give these men their special work to dey do for Tabernacle Tent.

40 Na 2,630 men for Gershon family group qualify to do this work.

41 Naso dem give these men from Gershon family group their special to dey do for Tabernacle Tent. Moses and Aaron do wetin God don tell Moses to do.

42 Dem also count Merari family group too.

43 Dem count all the men from 30 to 50 years old wey qualify to serve. Dem give these men their special work to dey do for Tabernacle Tent.

44 Na 3,200 men for Merari family group qualify to do this work.

45 Naso dem give these men from Gershon family group their special to dey do for Tabernacle Tent. Moses and Aaron do wetin God don tell Moses to do.

46 Naso Moses, Aaron, and Israelite leaders count all people wey dey for Levi family group. Dem don count each family and each family group.

47 Dem count all men wey qualify to serve between age of 30 and 50. Dem give these men their special work to dey do for Tabernacle Tent. Na to dey carry Tabernacle Tent when dem dey travel be the work dem dey do.

48 The total number na 8,580.

49 Dem count each man, just as God don command Moses. Dem give each man him own work and tell them wetin he go carry, just as God don talk.

Open Bible reader