Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Micah 6

1 Make una hear the case wey God get against Israel. Arise, O LORD, and tender your case; let mountains and hills hear wetin you say.

2 You mountains, you everlasting foundations of the earth, make una hear God case! God get case against him people. He go bring accusation against Israel.

3 God talk say, “My people, wetin I don do for una? Shey I don dey disturb una too much? Shey I make life hard for una?

4 I bring una out of Egypt; I save una from slavery; I send Moses, Aaron, Miriam make dem lead una.

5 My people, make una remember wetin King Balak of Moab plan to do to una and how Balaam son of Beor answer am. Make una remember the things wey happen on the way as una dey move from camp wey dey Acacia go Gilgal. Remember these things and una go know wetin I do to save una.”

6 Wetin I go bring to the LORD, the God of heaven, when I come worship him? Shey make I bring best calves come burn for offering to him?

7 Shey he go like am if I bring thousands of sheep or plenty olive oil? Shey make I offer him my firstborn child to pay for my sins?

8 No, God don tell us wetin dey good. Na wetin he dey ask from us be this: to dey do wetin dey right, to dey show love everytime, and to dey respect and obey God.

9 Na wise thing to fear God. He call the city say, “Make una hear me, una wey gather together in the city!

10 Shey the wicked still dey hide the treasure wey dem steal? Shey dem still dey cheat people with false measure? Yes, all these thing still dey happen!

11 How I go fit forgive those wey use false scales and weights?

12 Una rich people dey cheat the poor, and na all of una be liars.

13 So I don begin to punish una and destroy una because of una sins.

14 Una go chop, but una no go bellefull - infact, una go still dey hungry. Una go caryy things run, but una no go fit save them; I go use war destroy anything una save.

15 Una go sow corn, but una no go harvest am. Una go press oil from olives, but una no go fit use am. Una go make wine, but una no go drink am.

16 This thing go happen because una don follow the evil practice of King Omri and him son, King Ahab. Una don continue their law, and so I go punish una and everybody go hate una. People for everywhere go dey disrespect una.

Open Bible reader