Nigerian Pidgin Bible
Micah 1
1 During the time wey Jotham, Ahaz, and Hezekiel be king for Judah, God give Micah wey come from the town of Moresheth this message. God show Micah these things about Samaria and Jerusalem.
2 Make una hear this, all you nations; and make una hear this, una wey dey live on top earth! Almighty God go testify against una. Make una hear as he dey talk from heavenly temple.
3 God dey come from him holy place; he go come down and waka for mountain top.
4 Naso the mountain go melt under him like candle wey dey for fire; dem go pour down for valley like water dey pour down from hills.
5 All this go happen because people of Israel don sin and turn away from God. Who we go blame for Israel sin? Na Samaria wey be capital city! Wey dey guilty say dem dey worship idol for Judah? Na Jerusalem Itself!
6 Naso God say, I go make Samaria perish for open country, a place where people go dey plant grapevines. I go pour down the stone wey remain for the city inside valley, na only the foundation go remain.
7 All her precious idols, I go break them to pieces, fire go destroy everything wey dem don give the temple prostitues, and all her statues go become empty heaps. Samaria get all these things for rituals, and now her enemy go carry dem commot for temple prostitutes for other place.
8 Then Micah talk say, Because of this I go mourn and cry. I go waka naked and I no go wear shoe to show say I no dey happy. I go cry like vox and I go weep like ostrich.
9 Samaria wound no fit heal, and Judah go soon suffer the same way; destruction don reach the gate of Jerusalem, the place where my people dey live.
10 Make una no tell our enemy for Gath about our loss; make dem no see una dey cry. People of Beth Leaphrah, make una roll for dust to show say una no get hope!
11 Una people of Shaphir, make una go strange land naked and with shame. Those wey dey live for Zaanam no fit come out for their city. When una hear people of Bethezel dey cry, una go know say safety no dey there.
12 The people of Maroth dey wait for relief, because God don bring disaster near Jerusalem.
13 Una wey dey live for Lachish, join the horses to the chariots. Una copy the sin of Israel and una make Jerusalem sin.
14 And now, una people of Judah, make una say say goodbye to the town of Moresheth Gath. The king of Israel no go get help from town of Achzib.
15 People of Mareshah, God go give una to enemy, wey go capture una town. The leaders of Israel go hide inside cave of Adullam.
16 People of Judah, make una cut off una hair to mourn for the children wey una love. Make unaself bald like vulture, because dem go take una children from una go foreign land.