Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 7

1 “Mak una nor dey joj pipol enihaw, so dat God nor go joj una.

2 “Bikos, na as una joj, na so God go tak joj una and as una du oda pipol, na so dem go du una tu.

3 “Why yu dey si di smol dirti wey dey yor broda eye, bot yu nor dey si di big wud wey dey for yor own eye?

4 “Haw yu won tak tel yor broda sey, 'Mak I rimov di dirti wey dey yor eye, wen big wud dey yor own?'

5 “Yu wey dey pritend, first rimov di big wud wey dey yor eye, den yu go fit si di smol dirti for yor broda own.

6 “Mak una nor giv dog wetin bi God own or trow yor gold giv pig, bikos dem go mash am wit leg, turn face yu, den kon tear yu to pieces.

7 “Wen yu ask for somtin, God go giv am to yu; wen yu luk for somtin, yu go si-am and wen yu knok, di door go opun for yu.

8 “Enibodi wey ask for somtin, go get-am; enibodi wey dey faind somtin, go si wetin e dey faind and pesin wey knok door, dem go opun for am.

9 “E get eni of una wey en pikin ask am for bread and e kon gi-am stone?

10 “Or if di pikin ask for fish, yu go gi-am snake?

11 “If yu wey bad fit giv yor pikin gud tin, yu tink sey God wey dey hevun nor go giv beta tin to pipol wey ask am?

12 “Bikos of dis, mak yu trit pipol as yu wont mak dem trit yu, bikos na so dem rite am for di Profets and for Mosis law.

13 “Mak yu pas di smol gate enta, bikos di gate wey pipol go pas go sofa, wide wel-wel and meni pipol dey waka enta.

14 “Bot di gate wey pipol dey pas enta life, smol wel-wel and e hard to enta and na onli few pipol go fit si-am.

15 “Mak yu shine yor eye, bikos lai-lia profets go kom laik ship, bot for insaid dia heart, dem bi wiked anima wey dey kil.

16 “Yu go no dem wit wetin dem dey du. Pipol nor dey gada grape or fig from shuku-shuku.

17 “So tu, evri gud tri go bear gud frut, bot bad tri, go bear bad frut.

18 “Gud tri nor go fit bear bad frut and bad tri nor go fit bear gud frut.

19 “Eni tri wey nor bear gud frut, dem go kut-am dan kon trow am insaid fire.

20 “So, yu go no di lai-lia profets wit wetin dem dey du. “

21 “Nor bi evribodi wey dey kol God, 'Oga, Oga, go enta God Kindom, bot na onli di pipol wey dey du wetin my Papa for hevun wont.

22 “For dat day wey God go joj evribodi, meni pipol go sey, 'Oga, wi yuz yor name prish God mesage, driv meni dimon komot from pipol bodi and du meni mirakol.'

23 “Dat taim, I go sey, 'I nor no yu. Mak yu komot from wer I dey, yu wey wiked wel-wel!' “

24 “Enibodi wey hear my wod and du wetin I tok, e bi laik wise man wey build en haus on-top rock.

25 “Wen rain fal, wota kon ful di groun, den strong briz kon blow di haus, e nor go fal, bikos dem build am on-top rock.

26 “Bot enibodi wey hear my wod and e nor du-am, e bi laik foolish man wey build en haus on-top sand.

27 “Wen rain fal, wota kon ful di groun, den strong kon briz blow di haus, na wons e go fal skata for groun. “

28 Afta Jisos don tok all dis tins, di pipol kon sopraiz haw e dey tish,

29 bikos e tish dem laik pesin wey get authoriti and nor bi as dia law tishas dey du.

Open Bible reader