Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 6

1 “Mak una nor dey du gud bikos una wont mak pipol si una; if una du so, God nor go pay una for di gud wey una du .

2 “Enitiam una giv somtin to pipol, mak una nor show unasef as pritendas dey du for dia sinagog and road, so dat oda pipol go praiz dem. I tel una tru wod, dem don alredi get dia riwod.

3 “Bot wen una dey giv, mak una nor let una left hand no wetin una rite hand giv.

4 “So dat una gift, go dey sikrit and una Papa wey dey si for sikrit, go riwod una for pipol present. “

5 “Enitiam wey una dey pray, mak una nor du laik pipol wey dey pritend, wey laik to dey stand pray insaid sinagog and for road, so dat pipol go si dem. I tel una tru wod, dem don alredi get dia riwod.

6 “Bot wen una dey pray, mak una go insaid room, klose di door and pray to una Papa for sikrit. And una Papa wey dey si for sikrit, go riwod una for pipol present.

7 “Wen una dey pray, mak una nor tok won wod meni taims as pipol wey dey serv juju dey du, bikos dem tink sey dia juju go hear dem wen dia tok plenti.

8 “Mak una nor bi laik dem. Una Papa no wetin una nid bifor una bigin ask am.

9 “So mak una pray laik dis: 'Awa Papa wey dey for hevun, wi praiz yor name,

10 mak yor Kindom kom, mak wetin yu wont, hapun for dis wold as e bi for hevun.

11' Giv us di fud wey wi go chop evriday,

12 forgiv us all di bad-bad tins wey wi don du, as wi sef dey forgiv odas di bad tins wey dem du us.

13' Nor alow us enta temtashon bot mak yu save us from bad tins.'

14 “If una forgiv oda pipol di bad tins wey dem du una, una Papa wey dey for hevun go forgiv una tu.

15 “Bot if una nor forgiv odas, una Papa sef nor go forgiv una. “

16 “Wen una dey fast, mak una nor skwiz una face laik pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tel una tru wod, dem don alredi get dia ful riwod.

17 “Bot wen una dey fast, mak una wosh and rub pomade for una face,

18 so dat odas nor go no sey una dey fast, bot onli una Papa wey dey for sikrit go no. And una Papa wey dey si for sikrit, go riwod una for pipol present. “

19 “Mak una nor jos gada propati for dis wold, bikos ant go chop dem or dem go rust, or tif fit enta insaid di haus tif dem.

20 “Bot mak una gada beta tins for unasef for hevun, wer ant nor go fit chop dem and dem nor go rust and tif nor go fit enta,

21 bikos, wer una properti dey, na der una heart go dey tu.

22 “Na eye bi di lite for pesin bodi. If pesin eye dey okay, lite go ful en bodi.

23 “Bot if pesin eye blind, den daknes go ful en bodi. If di lite wey dey insaid una na daknes, di daknes big wel-wel!

24 “Nobodi go fit serv tu oga, e go hate won kon luv di oda won, or e go serv won wit all en heart and nor respet di oda won. Nobodi go fit serv God and moni for di same taim.

25 “So I tel una, mak una nor wori abaut una life, wetin una go chop or drink and wetin una go wear for bodi. Life nor big pas fud? Abi bodi nor beta pas klot?

26 “Mak una luk di birds wey dey flai for skai, dem nor dey plant or put enitin wey dem gada insaid store, bot una Papa for hevun dey fid dem. Una nor beta pas dem?

27 “Hu among una wey dey wori go fit add won hour join en life?

28 “Why una dey wori abaut klot wey una go wear? Mak una tink haw flawa dey grow for field; dem nor dey wok or mak klot wey dem dey wear.

29 “I tel una tru wod, ivun Solomon, upon all di moni wey e get, e nor wear klot wey fine rish di wons wey dis flawa dem dey wear!

30 “If God mak gras fine laik dis, gras wey una go si today and tumoro dem go trow am for fire, E nor go dress una pas dem? Una fate smol wel-wel o-o.

31 “So mak una nor wori kon dey sey, 'Wetin wi go chop' or 'Wetin wi go drink?' or 'Wetin wi go wear?'

32 “Na dis kaind tins pipol wey nor no God dey porshu and una Papa for hevun no sey una nid dem.

33 “Bot mak una first du di gud tins wey God wont and evri oda tin go bi una own.

34 “So mak una nor wori abaut tumoro, bikos tumoro get en own wahala. Today trobol don du."

Open Bible reader