Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 3

1 For dat taim, Jon di Baptist dey prish insaid desert for Judea sey,

2 “Mak una turn from sin kom mit God, bikos God Kindom don near. “

3 Na dis Jon Profet Isaia tok abaut sey, "Won pesin dey shaut insaid desert sey, 'Mak una mak God road strate.' “

4 Jon wear klot wey dem yuz camel hair mak, e yuz leda belt tie waist and na locust and honi for bush, e dey chop.

5 Pipol from Jerusalem, Judea and all di tawn wey dey near Jordan kon dey run go mit am

6 and e kon baptaiz dem insaid Jordan Riva, afta dem konfes dia sins.

7 Bot wen e si meni Farisi and Sadusi pipol dey kom mak e baptaiz dem, e kon tel dem, "Una, snake shildren! Hu warn una abaut God jojment wey dey kom?

8 “Naw, mak una du wetin go show sey una don turn from sin kom mit God,

9 mak una nor tink sey una don fri bikos una sey, 'Abraham na awa papa.' Mak I tel una, God fit turn all dis stone to Abraham shildren!

10 “Naw sef, dem don put di axe for di tri botom and eni tri wey nor bear beta frut, dem go kut am trow insaid fire.

11 “I dey baptaiz una wit wota mak una for turn from sin kom mit God, bot di pesin wey go kom afta, strong pas mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shu, na-im go baptaiz una wit Holi Spirit and fire.

12 “Di fan wey e go tak blow kanda from corn dey en hand and e go burn di dirti for fire wey nor dey kwensh. “

13 Jisos kom from Galili mak Jon for baptaiz am for Jordan Riva.

14 Bot Jon won kon stop am sey, "Na yu sopoz baptaiz mi, insted yu kom mit mi mak I baptaiz yu? “

15 Jisos ansa, "Mak e bi so naw, e beta mak wi du evritin wey God wont. “So, Jon kon baptaiz am.

16 As Jisos dey kom out from di wota afta Jon don baptaiz am, hevun opun and Jon kon si God Spirit wey bi laik dove, stay on-top Jisos head.

17 Naim won vois from hevun kon sey, "Dis na My pikin wey I luv and e dey mak bele swit mi."

Open Bible reader