Nigerian Pidgin Bible
Matthew 25
1 God Kindom bi laik wen ten virgins kari dia lamps go mit man wey won mari wife.
2 Faiv get sense and faiv nor get sense.
3 Wen di wons wey nor get sense kari dia lamps, dem nor tak extra kerosine folo bodi.
4 Bot di wons wey get sense kari extra kerosine.
5 E kon hapun sey di man wey won mari, nor kwik kom, so all di virgins kon slip.
6 For mid-nite, sombodi kon shaut, 'Mak una wak-up, di man wey won mari dey kom-o-o! Mak una kom mit am.'
7 So all di virgins wak-up, kon inkrease dia lite.
8 Bot di wons wey nor get sense kon tel di wise wons sey, 'Mak una giv us som kerosine, bikos awa lite won kwensh.'
9 Bot dem ansa, 'No! Wetin wi get nor go rish wi share, insted mak una go buy for unasef.'
10 Wen dem go buy, di man wey won mari kon kom and di wons wey dey redi kon enta di parti wit am and dem kon lock di door.
11 Afta, di oda virgins kon kom dey sey, 'Oga, Oga! Mak yu alow us enta.
12 Bot e ansa dem, 'No -o -o!, I nor no una!'
13 So, mak una dey redi, bikos una nor no di day or taim wen Kraist go kom.
14 Won man wey dey travol kon kol all en savants divide en propati giv dem.
15 E giv won faiv koins, giv anoda tu koins and di last, won koin. E giv ish savant wetin e go fit yuz, den e kon travol.
16 Di savant wey get faiv koins kwik-kwik go yuz en moni trade kon gain faiv koins join wetin e get.
17 Di same way, di savant wey get tu koins, gain tu extra koins join en own.
18 Bot di savant wey get won koin kon go dig hol for outsaid, hide di moni wey en oga gi-am.
19 Afta, dia oga kon kom bak mak e for no haw dem yuz di moni wey e giv dem.
20 Di savant wey e giv faiv koins, kon bring anoda faiv koins join en own, sey, 'Oga yu giv mi faiv koins. Si, I don gain faiv koins join dem.'
21 En oga kon tel am, 'Yu bi gud and wise savant and yu du wel! Since yu fit yuz di smol tins wey I giv yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Mak yu kom enjoy wit mi!'
22 Di won wey dem giv tu koins stil sey, 'Oga yu giv mi tu koins. Si, I don get tu koins join dem.'
23 En oga kon tel am, 'Yu bi gud and wise savant and yu du wel! Since yu fit yuz di smol tins wey I giv yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Mak yu kon enjoy wit mi!'
24 Den di savant wey e giv won koin kon sey, 'Oga, I no sey yu bi wiked man, yu dey havest wetin yu nor plant and dey pack fruts wey yu nor plok,
25 so fear kash mi and I kon hide yor moni for groun. So oga, mak yu tak wetin yu giv mi'
26 En oga kon tel am, 'Yu wiked and lazi savant! Since yu no sey I dey havest wetiin I nor plant and dey pack fruts wey I nor plok,
27 yu for put my moni for bank, so dat wen I kom bak, I go kolet my moni bak wit intres.
28 Mak una tak di moni from am and gi-am to di savant wey get ten.
29 Bikos di pesin wey get somtin go get more and wetin e get go plenti. Bot di pesin wey nor get, ivun di smol won wey e get, dem go tak am from am.
30 Mak una trow dat wiked savant insaid daknes for outsaid, wer e go krai and grind en tit.
31 Wen Man Pikin and en angels go kom wit en glori, e go sidan for en king throne .
32 Evribodi for di wold go gada for en front ande go seprate pipol as shepad dey seprate ship from goat.
33 E go kip di ship for en rite hand and di goat for en left.
34 Den di king go tel di pipol wey dey en rite hand, 'Mak una kom, una wey my Papa don bless and mak una inherit di kindom wey God priper for una bifor di wold start.
35 Wen I dey hungri, una giv mi fud, wen I dey thirsti, una giv mi somtin drink and wen I bi strenja, una let mi enta una haus.
36 I dey naked and una giv mi klot wear, wen I nor wel, una kare for mi, wen I bin dey prizin, una kom visit mi.'
37 Den di raitious pipol go ansa, 'Oga, wish taim wi si yu hungri and dey thirsti, kon fid and giv yu somtin drink?
38 Wish taim wi si yu as strenja, kon tak yu enta awa haus, or naked, kon giv yu klot wear?
39 Wish taim wi si yu wen yu nor wel or dey for prizin kon visit yu?'
40 Den di king go ansa, 'I tel una tru wod, jos as una du-am giv di pesin wey smol pas among my brodas and sistas, una don du-am for mi.
41 Di king go tel di pipol wey dey en left hand, 'Mak una komot from my side, una wey God don kos! Mak una enta hell fire wey dem priper for devol and en wiked angels.
42 Bikos di taim wey I dey hungri and thirsti, una nor giv mi fud and wota drink.
43 Di taim wen I bi strenja, una nor let mi enta una haus, wen I dey naked, una nor giv mi klot wear, wen I sik and dey for prizin, una nor kom visit mi.
44 Den, dem go ansa, "Oga, wish taim wi si yu dey hungri or won drink and wi nor giv yu fud or somtin to drink, wish taim yu bi strenja or naked or sik or dey for prizin and wi nor giv yu wetin yu wont?
45 Den, di king go ansa dem, "I tel una tru wod, jos as una nor du-am for di pesin wey smol pas among my brodas and sistas, una nor du-am for mi.
46 So wiked pipol go enta ponishment wey nor go end, bot raitious pipol go get life wey nor go end tu."