Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 19

1 Wen Jisos tok finish, e kon komot from Galili go Judea aria for di oda side for Jordan Riva.

2 Plenti pipol folo am and e heal all of dem.

3 Some Farisi pipol kom test and ask am sey, "E dey rite for man to driv en wife at all? “

4 Jisos kon ansa, "Yu neva read am from di biginin sey na man and wuman God mak

5 and bikos of dat, "Man go liv en papa and mama go join en wife and di tu of dem go kon bi won?

6 “So dem nor bi tu again, bot won. Diafor, wetin God don join togeda, mak enibodi nor skata am. “

7 Di Farisi pipol kon ask am again, "Wetin mak Mosis sey mak wi driv awa wife? “

8 Jisos ansa, "Mosis sey mak una driv una wife, bikos una heart dey wiked, bot nor bi so God plan am from biginin.

9 “Naw I tel una, enibodi wey driv en wife, wey nor bi sey e slip wit anoda man, bot kon mari anoda wuman, don komit adultri. “

10 Di disaipols kon tel Jisos, "If na so husban and wife mata bi, e beta mak pesin nor mari at-all? “

11 Jisos ansa dem, "Nor bi evribodi go fit asept dis wod, bot na onli di pipol wey God giv di pawa.

12 “Meni men nor fit slip wit wuman, bikos na so dem born dem, som na humanbin du dem laik dat, bot odas na bikos of God Kindom. Enibodi wey fit asept wetin I tok, mak e tak am laik dat. “

13 Some pipol bring shildren kon mit Jisos mak e put hand for dia head pray for dem. Bot di disaipols kon bigin kworel wit di pipol wey bring di shildren.

14 Bot Jisos tel di disaipols, "Mak una liv di smol shildren mak dem kom mit mi, nor stop dem, bikos na dem get God Kindom. “

15 So e put en hand for dia head, bless dem, den e waka komot der.

16 Won man kom mit Jisos, ask am, "Tisha, wetin I go du mak I for fit enta God Kindom.

17 Jisos ansa am, "Why yu dey ask mi abaut wetin gud? Na onli God gud. So if yu wont enta hevun, mak yu kip God komandments. “

18 Di man kon ask, "Wish won for di komandment? “Jisos ansa, "Mak yu nor kil, nor slip wit pesin wey nor bi yor wife, nor tif, nor tok wetin yor eye nor si,

19 respet yor papa and mama and mak yu luv yor nebor as yu luv yorsef. “

20 Di young man kon ansa, "I dey obey all dis law wit my heart. Wetin stil rimain wey I go du? “

21 Jisos kon tel am, "If yu won dey pafet, go sel evritin wey yu get, den giv di moni to poor pipol and yu go get beta tins for hevun. Wen yu don du so, mak yu kom folo mi. “

22 Wen di young man hear wetin Jisos tok, e kon ves waka komot, bikos e get moni wel-wel.

23 Den Jisos tel en disaipols, "I tel una tru wod, e go hard for pesin wey get moni wel-wel to enta God Kindom!

24 “Again I sey, e go eazi for camel to pas tru nido hol, dan for pesin wey get moni wel-wel to enta God Kindom. “

25 Di disaipols sopraiz wen dem hear dis tins and dem kon ask, "Den hu go fit dey save? “

26 Jisos luk dem kon ansa, "E nor posibol for humanbin, bot evritin dey posibol wit God. “

27 Den Pita kon tel Jisos, "Luk, wi don liv evritin wey wi get, kon folo yu! Wetin dey for us naw? “

28 Jisos ansa am, "I tel yu tru wod, for dat taim wen evritin go dey new, Man Pikin go sidan for en throne wey get glori and una wey dey folo mi, go sidan for twef thrones, dey joj di twef tribes wey dey Izrel.

29 “And enibodi wey liv en haus, brodas, sistas, papa or mama and land bikos of mi, go get am bak ondred taims and e go get life wey nor dey end.

30 “So meni pipol wey bi first naw, go bi last and dem wey bi last, go bi first."

Open Bible reader