Nigerian Pidgin Bible
Matthew 14
1 Dat taim, Herod wey dey rule hear abaut Jisos,
2 so e kon tel en savants, "Dis na Jon di Baptist wey wak-up from deat! Naim mak am get pawa to du all dis mirakol.
3 Bifor dis taim, Herod don arres Jon put for prizin, bikos Jon dey akuiz am sey,
4 E mari Herodias wey bi en broda Filip wife.
5 Herod kon get maind to kil Jon, bot e dey fear di pipol bikos dem biliv sey, Jon na profet.
6 So, for Herod betday, Herodias dota dance wel-wel kon mak Herod hapi.
7 Sotey Herod swear sey e go gi-am enitin wey e ask for.
8 Jos as en mama tel am, di girl kon ask, "Giv mi Jon di Baptist head for tray.
9 Di tin pain di King wel-wel, bot as e don swear and bikos of di pipol wey kom di parti, e kon komand mak dem go kil Jon.
10 So e send en sojas go kut Jon head for insaid prizin.
11 Dem bring di head for tray kon giv di girl and e kari am go giv en mama.
12 Den, Jon disaipols kon kari en bodi go bere and dem go tel Jisos wetin hapun.
13 Wen Jisos hear wetin hapun, e komot der enta boat go wer pipol nor dey. Bot wen pipol from difren-difren tawn hear wer e go, dem kon folo am.
14 As e kom dan from di boat, e si plenti pipol, so e sori for dem kon heal all di pipol wey nor wel among dem.
15 Wen evenin rish, en disaipols kom mit am sey, "Dis place na desert and day don dey dak. Mak yu send dis pipol go faind fud buy for demsef insaid di vilage.
16 Jisos ansa, "Dem nor nid to go, mak una faind somtin giv dem chop.
17 Dem kon tel am, "Na onli faiv bread and tu fish wi get for here.
18 Jisos ansa dem again, "Mak una bring di bread and fish kom.
19 Den e tel di pipol mak dem sidan for di grass. E tak di faiv bread and tu fish face hevun kon tank God. Afta e don tank God, e share di bread giv en disaipols mak dem giv di pipol.
20 All of dem chop beleful and wen dem gada di fud wey rimain, e rish twef basket.
21 Di pipol wey chop na abaut faiv tazon men, ivun doh dem nor kount wimen and shildren join.
22 Afta Jisos send di pipol go dia haus, e kon tel en disaipols mak dem enta boat kros go di oda side.
23 Afta di pipol don go, Jisos kon klimb go mountin go pray. E stay der go rish evenin.
24 By dis taim, di boat don go far from land. Strong wave kom dey kari di boat up and dan bikos heavi briz dey blow.
25 For earli mornin, Jisos kon dey waka go mit en disaipols on-top di wota.
26 Wen di disaipols si-am dey waka on-top wota, fear kash dem. Dem kon dey shake dey shaut, "Na ghost-o-o!
27 Bot Jisos kon tel dem, "Mak una heart strong! Na mi, mak una nor fear.
28 Naim Pita kon ansa, "Oga, if na yu tru-tru, kol mi mak I kom mit yu for di wota.
29 So, Jisos kon tel am, "Kom! Pita kon komot from di boat, dey waka on-top di wota go mit Jisos.
30 Bot wen e si as di briz strong wel-wel, fear kash am and e kon bigin sink. So e shaut, "Oga, save mi o-o!
31 At wons, Jisos kon stresh en hand kash am. E kon tel am, "Yor fite tu smol. Why yu dey doubt mi?
32 Wen di tu of dem don enta di boat, di briz kon stop.
33 Den di oda disaipols for di boat kon bow-down for Jisos front woship am sey, "Tru-tru, yu bi God Pikin.
34 Wen dem don kros di riva go di oda side, dem kon land for Genesaret.
35 Wen di pipol for der no sey na Jisos, dem send mesage go all dia vilage, den dem kon bring all dia sik pipol kom mit am,
36 dey beg am sey, "Mak di sik pipol tosh yor dress and all of dem wey tosh am, kon wel.