Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 10

1 Jisos kol en twef disaipols kon giv dem pawa to driv dimons and heal all diziz and siknes.

2 Dis na di twef disaipols name: Saimon Pita; Andru, wey bi Pita broda; James wey bi Zebedi pikin and en broda Jon.

3 Filip and Batlomi; Tomas; Matiu, wey bi tax koletor; James, wey bi Afius pikin and Tadius.

4 Saimon wey bi Zilot (pesin wey dey fite for en kontri) and Judas Iskarot wey sel Jisos Kraist.

5 Jisos send dem and tel dem, "Mak una nor go Gentai aria go prish and mak una nor enta Samaria pipol tawn,

6 bot mak una go mit Izrel pipol, wey bi God ship, wey loss.

7 “As una dey go, mak una prish di mesage sey; 'God Kindom don near!'

8 “Mak una heal pipol wey nor wel, wak pipol wey don die, kior lepas and driv dimons komot from pipol bodi. Na fri God giv una dis pawa, so mak una gi-am fri to oda pipol tu.

9 “Mak una nor kari eni moni folo bodi,

10 or kari bag or extra dress, sandal or wokin stick, bikos di pipol wey una go mit, go giv una evritin wey una nid.

11 “Wen una enta eni tawn or vilage, mak una luk for pesin wey redi to risiv una for en haus, mak una stay wit am ontil una komot from dat tawn.

12 “Eni haus wey una enta, mak una grit di pipol wey dey insaid.

13 “And if di pipol insaid di haus welkom una, mak una peace stay wit dem, bot if dem nor welkom una, una peace go kom bak to una.

14 “If di pipol nor welkom or listin to una mesage, mak una shake dia sand komot from una leg as una dey liv dat haus or tawn.

15 “I tel una tru wod, e go beta for Sodom and Gomorra pipol for jojment day, pas di pipol wey dey dat tawn. “

16 “Si! I dey send una go laik ship for wer plenti wiked animas dey, so mak una dey wise laik snake and gentol laik dove.

17 “Mak una redi, bikos pipol go arres una kari go kourt and flog una for dia sinagog.

18 “Bikos of mi, dem go drag una go mit rulas and kings, so dat una go tok abaut mi giv dem and di Gentai pipol.

19 “Mak una nor wori abaut wetin una go tok wen dem drag una go kourt, bikos God go giv una wetin to tok wen dat taim rish.

20 “Nor bi una go dey tok, bot na una Papa spirit go dey yuz una mout tok.

21 “Broda go sel en own broda giv pipol mak dem kil-am and na so papa go sel en own pikin tu. Shildren go fite and kil dia papa and mama.

22 “Evribodi go hate una bikos of mi. Bot enibodi wey fit bear rish di end, God go save am.

23 “Enitiam dem sofa una for won tawn bikos of mi, mak una run go anoda tawn. I tel una tru wod, una nor go run pas all di tawn for Izrel, bifor Man Pikin go kom bak.

24 “Nobodi big pas en tisha and no savant big pas en oga.

25 “E gud mak disaipol bi laik en tisha and mak savant bi laik en oga. If dem dey kol oga for en haus 'Belzibub (wey min dimon oga),' wot of di pipol wey dey di haus? Dem nor go kol dem bad name tu? “

26 “Mak una nor fear man, bikos nortin wey hide wey nor go kom out and no sikrit wey pipol nor go no.

27 “Wetin I tel una for daknes, mak una tok am for day taim and wetin I tok for una ear, mak una shaut am mak pipol hear.

28 “Mak una nor fear hu go fit kil di bodi and nor fit kil di soul. Insted, mak una fear God wey fit distroi pesin soul and bodi for hell fire.

29 “Nor bi won penni dem dey sel tu sparo bird? Bot no-one go fal rish groun, esept God alow am.

30 “Si! God no haw meni hair dey for una head.

31 “So, mak una nor fear, una beta pas meni sparo.

32 “Enibodi wey tok for publik sey en no mi, na so mi tu go tok abaut am giv my Papa for hevun.

33 “Bot enibodi wey denai mi for publik, misef go denai am for hevun. “

34 “Mak una nor tink sey, I bring peace kom dis wold. No! Na war I bring.

35 “I kom mak boy pikin nor gri wit en papa and mak girl nor gri wit en mama. Wife nor go gri wit en husban mama,

36 and pesin wos enemi, go bi en own famili pipol.

37 “Enibodi wey luv en papa, mama and pikin pas mi, nor go fit bi my disaipol.

38 “And enibodi wey nor kari en kros folo mi, nor go fit bi my disaipol.

39 “Enibodi wey hol en life tait, go luz am, bot enibodi wey luz en life bikos of mi, go gain am. “

40 “Enibodi wey welkom yu, welkom mi tu and enibodi wey welkom mi, welkom di Pesin wey send mi.

41 “Enibodi wey risiv profet, bikos na profet e bi, go get profet riwod. Enibodi wey risiv gud pesin, bikos na gud pesin e bi, go get gud pesin riwod.

42 “And enibodi wey giv kold wota to di pesin wey smol pas among my disaipols, I tel una tru wod, e nor go eva luz en riwod."

Open Bible reader