Nigerian Pidgin Bible
Mark 9
1 Jisos kon tel dem, "I tel una tru wod, som pipol dey here wey nor go die ontil dem don si God Kindom and en pawa."
2 Afta sis days, Jisos, Pita, James and Jon kon go won high mountin. E kon shange for dia front,
3 en klot kon dey shine wel-wel and e white pas haw eni dry-klina go fit wosh am.
4 Den Elija and Mosis kon apier for dia front dey tok wit Jisos.
5 So, Pita tel Jisos, "Tisha, e gud mak wi stay here. Mak wi build tiri canopi, won for yu, won for Mosis and won for Elija."
6 (Dem dey fear and dem nor no wetin to tok.)
7 Den, kloud kon kova dem and won vois kon tok from di kloud sey, "Dis na My onli pikin wey I luv. Mak una listin to am!"
8 Wen dem luk roun, dem nor si enibodi esept Jisos.
9 As dem dey kom dan from di mountin, Jisos kon tel dem mak dem nor tel enibodi wetin dem si, ontil Man Pikin go don wak-up from deat.
10 Den dem kon dey tok wit ish oda abaut wetin dis "Wak-up from deat" min.
11 Dem kon ask Jisos, "Wetin mak di law tishas dey sey Elija go first kom?"
12 Jisos ansa dem, "Tru-tru, Elija go first kom, mak e for priper evritin. Naim mak dem rite for God wod sey, 'Man Pikin must sofa meni tins and dem must hate am?'
13 "Bot I dey tel una naw sey, Elija don kom tru-tru and dem don du-am wetin dem laik, jos as God tok for en wod.
14 Wen Jisos, Pita, James and Jon kom mit di oda disaipols, dem si meni pipol and di law tishas gada, dey argue wit dem.
15 Wen di pipol si Jisos, dem sopraiz kon run kwik-kwik go grit am.
16 Jisos ask dem, "Wetin una dey argue abaut?"
17 Won pesin among di pipol kon ansa, "Tisha, I bring my pikin wey get dimon wey dey mak am nor fit tok, kom mit yu.
18 "Enitaim di spirit seize am, e go trow am dan and e go dey bring foam from en mout, dey grind en tit and en bodi go kon strate. I tel yor disaipols mak dem driv di dimon komot, bot dem nor fit."
19 Jisos kon ask en disaipols, "Una wey nor biliv! Haw long I go stay wit una? Haw long I go dey bear wit una? Mak una bring di boy kom mit mi."
20 So, dem tak di boy go mit am. Wen di spirit si Jisos, e kwik-kwik trow di boy for groun kon mak am dey shake. Di boy fal for groun, dey rol and foam dey komot from en mout.
21 Jisos ask di boy papa, "Since wen dis tin don dey du-am?" Di papa kon ansa, "Na since e bi smol pikin.
22 "Di spirit dey always trow am insaid fire or wota mak e for die. Bot if yu go fit du enitin, mak yu sori for am and help us."
23 Den Jisos ask am, "Yu min, 'If I fit?' Evritin dey posibol for di pesin wey biliv."
24 Kwik-kwik di boy papa kon shaut, "I biliv o-o! Help mi mak I biliv more-more!"
25 Wen Jisos si sey pipol dey gada, e kon tel di evil spirit, "Yu deaf and dumb spirit, I komand mak yu kom out from di boy and nor enta en bodi again."
26 Di dimon shaut, shake di boy wel-wel kon komot from en bodi. Di boy slip for groun sotey meni pipol kon dey sey, "E don die!"
27 Bot Jisos hol di boy hand smol-smol, kari am up and di boy kon stand-up.
28 Wen e enta haus, en disaipols kon ask am, "Why wi nor fit driv di dimon komot?"
29 Jisos ansa dem, "Na onli wit praya and fastin dis kaind won dey tak komot."
30 Jisos and en disaipols kon komot from der pas Galili. Bot Jisos nor wont mak enibodi no,
31 bikos e dey tish and tel en disaipols sey, "Dem go sel Man Pikin giv humanbin. Dem go kil-am and afta tiri days, e go wak-up again."
32 Bot di disaipols nor undastand wetin Jisos tok and fear nor let dem ask am wetin e min.
33 Dem kon rish Kapanum. So, wen Jisos don enta haus, e kon ask en disaipols, "Wetin una dey tok for road?"
34 Bot dem nor ansa, bikos wen dem dey kom for road, na hu big pas among dem, dem dey argue abaut.
35 Afta Jisos sidan, e kol en twef disaipols kon tel dem, "If enibodi among una won bi first, e go bi di last and e go bi evribodi savant."
36 E kon kol won smol pikin stand for dia front. Den e hol di pikin hand, kon sey,
37 "Enibodi wey welkom won of dis smol pikin bikos of mi, na mi e welkom and enibodi wey welkom mi, nor bi mi alone e welkom, bot na my Papa wey send mi."
38 Jon kon tel am, "Tisha, wi si won man wey yuz yor name dey driv dimon komot from insaid pipol bodi and wi kon trai to stop am, bikos e nor dey folo us waka."
39 Bot Jisos ansa dem, "Mak una nor stop am, bikos nobodi wey yuz my name du mirakol go fit tok bad tin abaut mi.
40 "Bikos enibodi wey nor dey against us, dey for awa side.
41 "I tel una tru wod, enibodi wey giv yu cup of wota bikos yu dey folo mi, nor go eva luz en riwod.
42 "If enibodi mak won of dis smol pikin wey biliv mi komit sin, e go beta mak dem tie big stone for en neck kon trow am insaid riva.
43 "If yor hand go mak yu sin, mak yu kut am komot! E beta mak yu enta insaid God Kindom wit won hand, dan to get tu hand kon enta hell fire wey nor go eva kwensh,
44 di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh.
45 "If yor leg go mak yu sin, mak yu kut am komot. E beta mak yu enta God Kindom wit won leg, dan to get tu leg kon enta hell fire wey nor dey eva kwensh,
46 di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh.
47 "If yor eye go mak yu sin, mak yu pul am komot! E beta mak yu enta God Kindom wit won eye, dan to get tu eye kon enta hell fire wey nor dey eva kwensh,
48 di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh.
49 "God go trai evribodi wit fire.
50 "Salt gud, bot if e nor get taste again, haw pesin go fit tak mak am swit? Mak una get salt insaid una and mak una dey liv for peace wit ish oda."