Nigerian Pidgin Bible
Mark 15
1 For earli mornin afta dem don plan wetin dem go du Jisos, di prist oga dem wit di law tishas and di Sanhedrin, tie am kon tak am go mit Pilate.
2 So Pilate ask Jisos, "Na yu bi di Ju pipol king?" Jisos ansa, "Na as yu tok."
3 Den di prist oga dem stil dey akuiz am,
4 so Pilate ask Jisos again, "Yu nor get enitin to tok? Yu dey hear all dis tins wey dem sey yu du?"
5 Bot Jisos nor tok enitin and dis tin kon sopraiz Pilate wel-wel.
6 Enitaim wen dem dey du di Passova Fist, Pilate always dey fri won prizina wey di pipol ask for.
7 Barabbas, won man wey kil pesin for di taim wey dem dey rayot, dey prizin wit pipol wey nor dey obey govment law.
8 Den di pipol kom mit Pilate kon ask am sey, mak e fri won prizina for dem, as e dey du bifor.
9 So Pilate ask dem, "Una wont mak I fri Ju pipol king for una?"
10 (Pilate no sey di prist oga dem bring Jisos to am, bikos dem dey jelos).
11 Bot di prist oga dem tel di pipol mak dem ask Pilate mak e fri Barabbas.
12 So Pilate ask dem again, "Den wetin una wont mak I du to dis man wey una kol Ju pipol king?"
13 Dem kon shaut, "Kil am trowey!"
14 Pilate ask dem, "Why? Wish bad tin e du?" Bot dem kon dey shaut more-more, "Kil am trowey"
15 Bikos Pilate won du wetin di pipol wont, e kon fri Barabbas for dem, den afta e tel en sojas mak dem flog Jisos, e kon giv Jisos to di pipol mak dem go kil-am.
16 So di sojas push Jisos enta di varanda for di govnor palise kon kol evribodi gada.
17 Dem wear am purpol klot kon tak shuku-shuku mak krawn wear for en head.
18 Dem kon dey salot am, "Wi hail yu o-o, Ju pipol king!"
19 Dem tak stik nak am for head kon spit for en bodi. Dem kon nil dan for en front dey bow for am.
20 Wen dem don laff am finish, dem pul di purpol klot komot from en bodi kon wear am en own klot. Den, dem kon go kil-am.
21 Di sojas kon fos Saimon, won man from Syrene, wey jos dey enta di tawn, mak e kari Jisos kros. (Di man na Alexander and Rufus papa.)
22 Dem tak Jisos go di place wey dem dey kol Golgota (wey min, "Skul Place").
23 Dem gi-am wine wey dem mix wit myrrh, bot Jisos nor gri drink am.
24 Dem nail am for kros kon divide en klot, dey trow dice mak dem for no wetin go rish ish pesin.
25 Na nain o' klok for mornin dem nail Jisos for kros.
26 Dem kon rite sey, "Dis na Ju pipol king."
27 Dem nail tu tif wit am for kros, won for en left and di oda for en rite side.
28 Wetin dem rite for God wod kon hapun sey, "Dem kount Jisos join bad pipol."
29 Pipol wey dey waka pas kon dey shake dia head and dey tok bad abaut am sey, "Eehen! Yu wey sey, yu go fit distroi di Tempol kon build am again for tiri days.
30 "O-ya! Save yorsef mak yu kom dan from di kros!"
31 Ivun di prist oga dem and di law tishas dey laff Jisos for wer dem sidan, dey sey, "E save oda pipol, bot e nor fit save ensef!
32 "Kraist, wey sey e bi Izrel king, mak e kom dan from di kros naw mak wi si-am, so dat wi go biliv!" Doz wey dem nail for kros wit am kon dey kos am tu.
33 Wen twef o' klok for aftanoon rish, daknes kon kova di kontri ontil tiri o' klok for aftanoon.
34 Aroun tiri o' klok, Jisos kon shaut sey, "Eloi! Eloi! Lama Sabaktani?" Wey min, "My God! My God! Wetin mak Yu abandon mi?"
35 Wen som pipol wey stand near der hear wetin e tok, dem kon sey, "Listin. E dey kol Elija!"
36 Den won pesin run kom wit foam kon soak am insaid bita wine, den e put am for stik giv Jisos mak e drink, den e kon sey, "Mak una liv am! Mak wi si weda Elija go kom save am."
37 Bot Jisos shaut again, den e kon die.
38 So di kurtain for di Tempol kon tear into tu from top go rish botom.
39 Wen di soja wey stand for Jisos front si haw e tak die, e kon sey, "Tru-tru dis man na God Pikin!"
40 Som wimen dey der dey luk from far. Dem bi Mary Magdalene, Mary wey bi Joses, James and Salome mama.
41 For di taim wen Jisos dey Galili, dis wimen dey folo and help am. Meni oda wimen wey folo am kom from Jerusalem, dey der tu.
42 Wen evenin don rish for di day bifor di Sabat,
43 Josef wey kom from Arimatia, wey bi Ju kansol memba, wey dey wait for God Kindom and pipol dey respet am wel-wel, go mit Pilate kon ask for Jisos bodi.
44 Pilate sopraiz sey Jisos don die. So e kol di soja kon ask am weda e don tey wen Jisos die.
45 Wen Pilate hear wetin di soja tok, e kon sey mak Josef go kari di bodi.
46 Josef buy linen klot, bring Jisos bodi kom dan from di kros kon tak di klot rap am, den e put am for grave wey dem dig insaid rock. Den e rol big stone kova di grave mout.
47 Mary Magdalene and Mary wey bi Joses mama dey luk and dem si wer dem bere Jisos put.