Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Luke 19

1 Jisos enta Jeriko kon waka go insaid di tawn.

2 For der, e get won man wey en name bi Zakius. E get moni wel-wel, bikos e bi tax koletors oga. E don tey wey e

3 dey won si Jisos, bot e nor fit si-am, bikos e bi short man and pipol too plenti.

4 So e run go klimb won sikamore tri mak e for fit si-am, bikos Jisos go pas dat road.

5 Wen Jisos rish dat place, e luk up kon sey, "Zakius, kom dan kwik-kwik, bikos I must stay for yor haus today."

6 So Zakius kom dan kon welkom Jisos wit hapines.

7 Wen di pipol si wetin hapun, dem kon dey komplain dey sey, "Jisos don go visit dat man wey bi sina."

8 Bot Zakius stop kon tel Jisos, "Oga si, I go giv haf of wetin I get to poor pipol and evribodi wey I don shit bifor, I go pay am bak for taims!"

9 Den Jisos sey, "Salvashon don kom dis haus today, bikos dis man na Abraham pikin tu.

10" Man Pikin kom faind and save pipol wey loss bifor."

11 As Jisos dey waka near Jerusalem, e kon tel di pipol won parabol to show sey God Kindom nor go jos kom laik dat.

12 Jisos kon sey, "Won big man travol go won far kontri wer dem for won mak am king and afta, e kom bak.

13 Bifor e go, e kol ten of en savant kon giv ish won moni sey, 'Mak una tak dis moni trade and mak profit til I kom bak.'

14 "Bot e own pipol nor laik am, so dem kon send mesage folo am sey, 'Wi nor wont dis man to bi awa king!'

15 "Wen e kom bak afta e don get di kindom, e kon kol en savants wey e giv moni mak e for no haw mush dem don gain.

16 "So di first won stand for en front sey, 'Oga, I don gain ten koins join di wons wey yu giv mi.'

17 "Di oga kon tel am, 'Yu du wel, yu bi gud savant! Bikos yu dey fateful wit smol tin, I go mak yu oga ova ten tawns.'

18 "Den di sekon won sey, 'Oga, I don gain faiv koins join di wons wey yu giv mi.'

19 "So di oga tel am, 'Yu go bi oga for faiv tawns.'

20 "Den anoda savant kon sey, "Oga, si di moni wey yu giv mi. I kip am insaid klot.

21 "Bikos I dey fear and no sey yu hash wel-wel. Yu dey chop fud wey nor bi yor own and yu dey plok frut wey yu nor plant!'

22 "Di oga kon tel am, 'Na yor wod I go tak joj yu, yu wiked savant! So yu no sey, I bi hash man, dey chop fud wey nor bi my own and I dey plok frut wey I nor plant?

23 'Den why yu nor put my moni for bank, so dat wen I kom, I go kolet am wit intres wey go dey on-top?'

24 "Den di oga tel di oda savants, 'Mak una tak di moni from am, gi-am to di savant wey get ten.'

25 "Dem ansa, 'Oga, di man don alredi get ten!'

26 Di oga kon sey, "I tel una, enibodi wey get, God go gi-am more, bot di pesin wey nor get, ivun di smol won wey e get, God go tak am from am.'

27 "Bot doz my enimi wey nor wont mak I bi dia king, mak una go bring and kil dem for my front!"

28 Afta Jisos tok dis wod, e kon go Jerusalem.

29 Wen e rish Betpage and Betani, for di place wey dem dey kol Mount Olives, e kon send tu of en disaipols sey,

30 "Mak una go di vilage wey dey front. Wen una enta, una go si won smol donkey wey nobodi don sidan put bifor, wey dem tie for der. Mak una luz am kom giv mi.

31 "If enibodi ask una, 'Why una dey luz am?' Mak una ansa, 'Di oga nid am.'"

32 So di pipol wey dem send go, kon rish di place wey Jisos tel dem.

33 As dem dey luz di donkey, di owna kon ask dem, "Why una dey luz am?"

34 Dem kon ansa, "Di oga nid am."

35 Dem tak di donkey kon put dia klot on-top am, den Jisos sidan put.

36 As Jisos dey ride dey go, pipol kon spread dia klot for road.

37 As e dey enta di road wey go Mount Olives, all di disaipols kon dey hapi, dey praiz God wit loud vois for all di mirakols wey dem si.

38 "God don bless di king wey dey kom wit en name! Mak peace dey for hevun and mak all di glori bi God own!"

39 Bot som Farisi pipol wey dey among di pipol kon tel Jisos, "Tisha, mak yu tel yor disaipols mak dem kwayet."

40 Jisos kon ansa, I tel una tru wod, if dem kwayet, ivun stones go start to dey shaut!"

41 Wen Jisos near Jerusalem, e luk di tawn kon dey krai,

42 den e kon sey, "I wish sey una no wetin go giv una peace today! Bot naw, God don hide am from una.

43 "Taim go kom wen una enimis go suroun una for evri kona kon blok una road.

44 "Dem go distori una and una shildren and dem nor go liv won blok on-top anoda, bikos di taim wen God kom visit una, una nor no."

45 Jisos enta di Tempol kon driv all di pipol wey dey sel tins for der,

46 e kon sey, "God wod sey, 'My haus na praya haus', bot una don turn am to haus wer tif dey hide put!"

47 Jisos kon dey tish evriday for di Tempol. Di prist oga dem, di law tishas wit di big lidas among di pipol kon dey faind haw dem go tak kil Jisos.

48 Bot dem nor get eni shanse, bikos pipol dey listin to wetin Jisos dey tish.

Open Bible reader