Nigerian Pidgin Bible
Luke 17
1 Jisos tel en disaipols, "Tins wey go mak pipol komit sin must hapun, bot e go bad wel-wel for di pesin wey go mak dem hapun!
2 "E beta mak dem tie big stone for di pesin neck, trow am for riva, dan sey e mak eni of dis smol-smol wons komit sin.
3 "Mak yu shine yor eye! If yor broda sin, mak yu tel am. If e turn from sin kom mit God, den, mak yu forgiv am.
4 "Ivun if e sin against yu sevun taims for won day and e kon tel yu sevun taims sey, 'I don shange', yu must forgiv am."
5 Di disaipols kon tel Jisos, "Wi beg! Mak yu mak awa fate strong."
6 Jisos ansa, "Ivun if una fate smol laik mustard sid, una go fit tel dis big tri sey, 'Mak yu komot from here go enta riva' and e go obey una.
7 "Wish of una go tel en savant wen e kom from farm afta e don fid di ship and melu finish sey, 'Kom sidan, mak yu folo mi chop'?
8 "No! Insted una go tel am, 'Priper my evenin fud and serv mi, mak I chop and drink. Wen I don finish, yu fit go chop yor own.'
9 "Di oga nor go tank di savant sey e du wetin e send am, abi e go du so?
10 "Na so tu e go bi wit una. Wen una don du all wetin dem send una, mak una sey, 'Na savant wi bi, wi nor rish mak dem praiz us, bikos wi jos du wetin wi sopoz to du.'"
11 As Jisos dey go Jerusalem, e kon pas di place wey divide Samaria and Galili.
12 As e dey enta won vilage, ten men wey get leprosi mit am for road. Dem stand for far,
13 kon dey shaut, "Oga Jisos! Wi beg, mak yu sori for us."
14 Wen Jisos si dem e kon sey, "Mak una go show unasef to di prists." And as dem dey go for road, dia bodi kon wel.
15 Wen won of dem si sey e don wel, e kon turn bak dey shaut dey praiz God.
16 E fal face groun for Jisos front kon dey tank am. (Di man na from Samaria.)
17 Den Jisos ask, "Nor bi ten pipol l heal? Wer di oda nain?
18 "Na onli dis man wey bi strenja fit kom bak kon praiz God?"
19 Den Jisos tel di man, "Get up mak yu dey go. Yor fate don mak yu wel."
20 Won day, di Farisi pipol kon ask Jisos wen God Kindom go kom. Jisos ansa, "God Kindom nor go kom wit sign wen pipol go si
21 and nobodi go fit sey, 'Si-am for here!' Or 'Si-am for der!' Bikos tru-tru, God Kindom don alredi dey wit una."
22 Den Jisos tel en disaipols, "Di taim dey kom wen una go won si Man Pikin, bot una nor go si-am.
23 "Dat taim, pipol go tel una, 'Si-am for der!' or 'Si-am for here!' Mak una nor folo dem.
24 "Bikos as thunda lite dey flash from won side go anoda for skai, na so Man Pikin go kom for en taim.
25 "Bot e must first sofa meni tins and di pipol for dis generashon go rejet am.
26 "As e bi for Noah taim, na so e go stil bi for Man Pikin taim.
27 "Dat taim, pipol dey chop and drink, ivun for di day wen Noah enta di ark, men and wimen stil dey mari, ontil wota kon distroi all of dem.
28 "Na so e stil bi for Lot taim, pipol dey chop and drink, dey buy and sel, dey plant and build haus;
29 bot di day wen Lot komot from Sodom, fire and sulfur fal laik rain from hevun kon kil all of dem.
30 "Na so e go bi for di day wen Man Pikin go show ensef.
31 "Dat day, enibodi wey dey on-top root for en haus, mak e nor go insaid haus go kari enitin and enibodi wey dey farm, mak e nor go bak to en haus.
32 "Mak una rimemba wetin hapun to Lot wife!
33 "Enibodi wey won kip en life, go luz am and enibodi wey luz en life, go save am .
34 "I tel una tru wod, dat nite, tu pipol go dey won bed, God go tak won kon liv di oda won.
35 "Tu wimen go dey grind pepper togeda; God go tak won kon liv di oda won.
36 "Tu pipol go dey farm dey wok; God go tak won kon liv di oda won."
37 Den di disaipols ask Jisos, "Oga, for wer dis tins go for hapun?" Jisos ansa, "Yu si, na wer dead bodi dey, na der vultures dey gada put."