Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Leviticus 6

1 God tell Moses say,

2 “Suppose say una sin against una fellow Israelite, and no dey faithful to God. Suppose say anyone cheat for a deal wey dey involve security deposit, or him thief or do fraud,

3 or him find something wey don lost and lie about am, or him lie when he dey swear say he dey talk true, or even any other sin wey be for this way.

4 When a man don sin for any kind of this way, he dey guilty. Make he give back anything wey he don thief.

5 On the day wey dem find am guilty, he go pay the owner in full, plus additional twenty percent.

6 He go bring male sheep or goat wey no get error to the priest for repayment offering to God. Na official standard dem go use value am.

7 The priest go offer sacrifice for the man sin and he go receive forgiveness.

8 God command Moses

9 make he give Aaron and him son the regulations wey follow for burnt offering. Make dem leave burnt offering on top altar, and make the fire continue to dey burn.

10 Then, as the priest dey wear him linen robe and shorts, he go remove the ashes wey remain for altar and put am for alter side.

11 Then he go change him cloth and take the ashes go place wey dey clean outside camp.

12 Make the fire wey dey on top altar continue to dey burn, make e no die. The priest go dey put firewood on am every morning, arrange burnt offering on am, and burn fat of fellowship offering.

13 Make the fire wey dey on top altar continue to dey burn, make e no die.

14 Na regulation for grain offering be this. Aaronite priest go present the offering to God for front of altar.

15 Then he go take handful of the flour and oil, and the incense on am, and burn am on top altar as token say he don offer all of am to God. The offering smell dey please God.

16-

17 The priest go eat the rest of am. Make dem use am bake bread and eat am for holy place, the courtyard of Tabernacle Tent. God don give am to priests say na him share of food offering. E dey very holy, like sin offering and repayment offering.

18 For time to come, any male descendants of Aaron fit eat am as their share of food wey dem offer to God. Any other person wey touch the food, power of the holiness go harm the person.

19 God give Moses regulations

20 to dey use ordain Aaronite priest. On the day wey dem ordain him, he go present offering to God one kilogram of flour (same amount like daily grain offering), half for morning and half for evening.

21 Mix am with oil and cook am on top griddle and break am and present am as grain offering, a smell wey dey please God.

22 For time to come, descendant of Aaron wey dey serve as High Priest go make this kind offering. Make dem burn am completely as sacrifices to God.

23 Make nobody eat the grain offering wey the priest make; burn all of am.

24 God command Moses

25 say make he give Aaron and him son rule for sin offering. Make dem kill animal wey be for sin offering for north side, where dem dey kill animals for burnt offering. Na very holy offering e be.

26 The priest wey sacrifice the animal go eat am for holy place, for courtyard of the Tent.

27 Power of holiness go harm anybody or anything wey touch the flesh of the animal. If any part of the animal splash with the animal blood, make dem wash am for holy place.

28 Make dem break any clay pot wey dem use boil the meat, and if dem use metal pot, make dem scrub am and wash am with water.

29 Any male for priest family fit eat this offering; e dey very holy.

30 But if dem bring any of the blood inside Tent and dem go use am for ritual to take sin away, make dem no eat the animal, make dem burn am.

Open Bible reader