Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Leviticus 11

1 God give Moses and Aaron the rules wey follow

2 for people of Israel. Una fit eat any land animal

3 wey get divided hoofs and wey dey also chew cud,

4-

6 but make una no eat camels, rock-badgers, or rabbits. Make una dey see them like say dem no clean; dem dey chew cud, but dem no get divided hoofs.

7 Make una no eat pigs. Dey see them like say dem no clean; dem get divided hoofs, but dem no dey chew cud.

8 Make una no dey eat this animal or even touch their dead body; dem no clean.

9 Una fit eat any kind fish wey get fins and scales,

10 but make una no eat anything wey dey live inside water wey no get fins and scales.

11 Make una dey look that kind animal like say e no clean. Make una no eat them or even touch their dead body.

12 Make una no eat anything wey dey live inside water wey no get fins and scales.

13-

19 Make una no eat any of the birds wey follow; eagle, owl, hawk, falcon, buzzard, vulture, crow; ostriches; seagull, stork, heron, pelican, cormorant; hoopoes; or bats.

20 All insects wey get wing no clean,

21 apart from the ones wey dey jump.

22 Una fit eat locust, crickets, or grasshopper.

23 But make una dey consider all other small things wey get wings and dey crawl say dem no clean.

24-

28 Anyone wey touch dead body of animals wey follow no go dey clean till evening: all animal wey get hoofs, unless their hoofs dey divided and dem dey chew cud, and all animal wey get four feet with paws. Make anyone wey carry their dead body wash him cloth, but he go still dey unclean till evening.

29-

30 Moles, rats, mice, and lizards no dey clean.

31 Anyone wey touch them or their dead body no go dey clean till evening.

32 And if their dead body fall on anything, e go be unclean. This thing dey apply to anything of wood, cloth, leather, or sack, no matter wetin dem dey use am for. Make una wash am inside water, but e go remain unclean till evening.

33 And if their body fall inside clay pot, everything wey dey inside the pot go be unclean; if na clay stove or oven, make una break am.

34 Any food wey una dey eat normally, but una don pour water from that kind pot on top go dey unclean, and anything drinkable in that kind pot don dey unclean.

35 Anything wey the dead body fall on top don turn unclean; make una break clay stove or oven,

36 but a spring or water tank go remain clean, although anything else wey touch their dead body na unclean.

37 If one of them fall on top seed wey una wan plant, the seed go remain clean.

38 But if una soak the seed inside water and one of them fall inside, the seed don turn unclean.

39 If any animal wey suppose dey for eating die, anyone wey touch am go dey unclean till evening.

40 And if anyone eat any part of the animal, make he wash him cloth, but he go still dey unclean till evening; anyone wey carry the dead body must wash him cloth, but he go still dey unclean till evening.

41 Make una no eat any small animal wey dey move on top ground,

42 whether dem dey crawl, or walk with four legs, or get many legs.

43 No make unasef unclean because say you wan eat anyone of them.

44 I be the LORD una God, and una must keep unasef clean, because I be holy.

45 I be the LORD wey bring una out of Egypt so that I fit be una God. Una must dey holy, because I be holy.

46 Na this be laws about animals and birds, everything wey dey live inside water, and everything wey dey waka on top ground.

47 Make una dey careful to separate between wetin dey clean or unclean for ritual, between animals una fit eat and the ones una no fit eat.

Open Bible reader