Nigerian Pidgin Bible
John 7
1 Afta, Jisos kon travol go evriwer for Galili. Den e komot for Judea, bikos di Ju oga dem won kil-am.
2 Di taim kon rish wen Ju pipol dey du dia fist wey dem dey kol Tabanakol Fist.
3 Jisos brodas kon dey tel am, "Komot for here go Judea, mak yor disaipols si di mirakols wey yu dey du.
4 "Bikos enibodi wey wont mak pipol sabi hu e bi, nor go du enitin for kona. Since yu dey du dis tins, e gud sey mak yu show yorsef to evribodi."
5 (Ivun en brodas nor biliv wetin Jisos dey du.)
6 Jisos ansa dem, "Taim neva rish for mi to go, bot una fit go enitaim una laik.
7 "Pipol laik una, bot dem nor laik mi, bikos I dey tel dem sey wetin dem dey du nor gud.
8 "Mak una go di fist, I nor go-go, bikos my taim neva rish."
9 Afta e don tok finish, e kon stay for Galili.
10 Bot wen en brodas don go di fist, Jisos kon go der tu, bot e nor let enibodi no sey e dey der.
11 Di Ju oga dem kon dey ask pipol, "Wer e dey?"
12 Dem kon dey tok among demsef. Som sey, "Jisos na gud pesin", bot odas sey, "E dey play pipol wayo."
13 Bot nobodi fit tok out, bikos dem dey fear di Ju oga dem.
14 Wen di fist don rish haf, Jisos enta di Tempol kon dey tish.
15 Di Ju oga dem sopraiz and dem kon dey sey, "Haw e tak no dis tins wey e dey tish so, as e bi sey e nor go school at-all?"
16 Jisos ansa dem, "Wetin I dey tish nor bi my own, bot na di Pesin wey send mi, na-im giv mi.
17 "Enibodi wey redi to du wetin God wont, di pesin go no weda wetin I dey tish na from God or na my own.
18 "Enibodi wey dey tok wit en own pawa, go wont mak pipol praiz am, bot di pesin wey won onor hu send am, naim dey du wetin koret and sin nor dey insaid am.
19 "Mosis nor giv una di law? Bot una nor gri obey am. Why e bi sey una won kil mi sef?"
20 Di pipol ansa Jisos, "Dimon don enta yor bodi! Hu won kil yu?"
21 Den Jisos ansa, "Na won mirakol wey I du so, mak una dey sopraiz?
22 "Na tru sey Mosis tel una to sekonsaiz una son, (nor bi Mosis start am, na from Abraham taim e start) and una dey sekonsaiz una son for Sabat Day.
23 "Since una dey sekonsaiz for Sabat so dat una nor go break Mosis law, why una dey ves wit mi, bikos I heal dis sik man for Sabat Day?
24 "Mak una nor dey joj pesin, bikos of wetin una si wit una eye, bot mak una giv koret jojment as e sopoz to bi."
25 Som pipol wey dey stay for Jerusalem kon dey sey, "Dis nor bi di man wey dem won kil?
26 "Naim dey here dey tok for publik so and dem nor fit tel am enitin. Abi di oga dem don gri sey naim bi di Kraist?
27 "Wi sef no di place wer dis man from kom and wi no sey enitaim wey Kraist go kom, nobodi go fit no wer e go kom from."
28 As Jisos dey tish for di Tempol, e kon shaut sey, "Una no mi and di place wey I from kom, nor bi my pawa I tak kom, na God wey send mi naim bi di koret Pesin. Bot una nor no am.
29 "Bot I no am wel-wel, bikos na from am, I kom and naim send mi."
30 Dem kon trai to kash Jisos, bot nobodi fit tosh am, bikos en taim neva rish.
31 Meni pipol for der biliv am kon sey, "Enitaim di pesin wey bi di Kraist kom, e go fit du mirakol wey pas wetin dis won dey du so?"
32 Wen di Farisi pipol hear pipol dey tok abaut Jisos, dia oga and di prists kon send sojas go arres am.
33 Jisos kon tel dem, "I go onli stay wit una for smol taim and afta, I go-go mit di Pesin wey send mi.
34 "Una go dey luk for mi, bot una nor go si mi and una nor go fit kom mit mi for wer I dey."
35 Den di Ju oga dem kon dey ask ish oda, "Wer e won go wey wi nor go fit si-am, abi e won go tish Ju pipol wey dey stay wit Greek pipol?
36 "Wetin e min wen e tok sey, 'Una go luk for mi, bot una nor go si mi and wer I dey, una nor go fit kom der?'"
37 For di last day for di fist, wey bi di biggest day, Jisos stand kon shaut, "If wota dey hungri enibodi, mak e kom mit mi.
38 "Di pesin wey biliv mi and wetin I tok, mak e kom drink, jos as God wod sey, 'Plenti wota wey dey giv life, go flow from insaid en bele.'"
39 (E tok dis tin abaut di Spirit wey di pipol wey biliv am go get, bikos by dis taim, God neva giv en Spirit to pipol, bikos E neva onor Jisos Kraist.)
40 Wen pipol hear wetin e tok, som of dem kon sey, "Tru-tru, dis man naim bi di Profet!"
41 Som stil sey, "Na-im bi di Kraist", bot odas sey, "Na lai, Kraist nor fit kom from Galili.
42 "Abi God wod nor sey, 'Kraist go kom from David famili wey dey Betlehem, di vilage wey David from kom?'"
43 So di pipol kon divide bikos of Jisos.
44 Som of dem kon dey trai to kash am, bot nobodi fit tak hand tosh am.
45 Wen di sojas go bak, di prist oga dem and Farisi pipol kon ask dem, "Why una nor kash Jisos kom?"
46 Di sojas ansa, "Wi neva si enibodi wey tok laik dis man bifor!"
47 Den di Farisi pipol kon ask di sojas, "Abi, e don disiv una tu?
48 "Abi eni of us wey bi Farisi pipol or prists don biliv Jisos?
49 "Kos dey dis pipol head, bikos dem nor no di law."
50 Den won man wey en name bi Nikodimos, wey don first go mit Jisos and wey bi won of di big oga dem kon sey,
51 "Awa law nor dey kondem pesin unles wi don hear wetin di pesin tok or si wetin e dey du, abi nor bi so?"
52 Dem kon ask am, "Abi na Galili yu tu from kom? If yu luk wel, yu go si sey no profet go fit kom from Galili."
53 Afta dis, evribodi bigin go en haus.