Nigerian Pidgin Bible
John 3
1 E get won man wey bi Farisi, en name na Nikodimos and e bi memba for di konsol wey dey rule Ju pipol.
2 E hide go mit Jisos for nite kon tel am, "Tisha, wi no sey yu bi di pesin wey God send kon mit us, bikos nobodi fit du di mirakols wey yu dey du, unles God dey wit am."
3 Jisos tel am, "Mak I tel yu tru wod, unles dem born pesin di sekon taim, e nor go fit si God kindom."
4 Den Nikodimos kon ask am, "Haw dem go fit tak born pesin wey don old for di sekon taim? Abi di pesin go enta en mama bele mak di mama born am again? E fit hapun laik dat?"
5 Jisos ansa am, "I tel yu di trut, unles God born pesin wit wota and en Spirit, di pesin nor go fit enta God kindom.
6 "Wetin flesh born, na flesh e bi, bot wetin God Spirit born, na spirit e bi.
7 "So, mak yu nor konfuz bikos I tok sey, 'God go born yu for di sekon taim.'
8 "Wen briz dey blow, e dey go eniwer e wont, yu dey hear di sound wey e dey mak, bot yu nor fit no wer e dey kom from or wer e dey go. Na so e bi wit evribodi wey God Spirit born."
9 Nikodimos kon ask am, "Haw dis tins go fit hapun?"
10 Jisos ansa, "Yu bi tisha for Izrel, yet yu nor fit undastand dis tins?
11 "Mak I tel yu di trut, wi dey tok wetin wi sabi and dey bear witnes for wetin wi don si wit awa eyes, bot una nor gri asept wetin wi tok.
12 "Naw, if I dey tel una abaut di tins wey dey for dis wold and una nor fit biliv wetin I tok, haw una go fit tak biliv mi, if I bigin dey tel una abaut di tins wey dey for hevun?
13 "Nobodi don go hevun bifor, esept Man Pikin wey kom dan from hevun and e go-go bak der.
14 "Yu si, as Mosis kari di snake go up wen dem dey insaid desert, na so tu dem go kari Man Pikin up,
15 so dat enibodi wey go biliv am, go get life wey nor dey end.
16 "Bikos God luv di pipol wey dey dis wold wel-wel, E kon send di onli pikin wey E get to us, so dat enibodi wey biliv am, nor go die, bot e go get life wey nor dey end.
17 "God nor send en pikin kom kondem di pipol wey dey insaid di wold, bot mak e kom save dem.
18 "Enibodi wey biliv am, God nor go kondem am. Bot di pesin wey nor biliv am, God don kondem am alredi, bikos di pesin nor biliv God Pikin name.
19 "Na dis bi di rizin why God go joj di wold, bikos lite don kom insaid di wold, bot pipol laik to stay for daknes insted of lite, bikos dem dey du tins wey nor gud.
20 "Yu si, evribodi wey dey du bad tin dey hate lite and dem nor go gri kom out for wer lite dey, mak pipol nor for si di bad tins wey dem dey du.
21 "Bot di pesin wey dey du gud tins, dey kom out for lite, so dat pipol go si di tins wey e dey du, bikos na as God wont, naim e dey du.
22 Leta, Jisos and en disaipols go Judea aria and dem kon stay der for som taim dey baptize pipol.
23 Jon dey baptize for Aenon, won tawn wey near Salim, bikos plenti wota dey der and pipol dey kom mit am mak e baptize dem.
24 (For dis taim, dem neva put Jon for prizin).
25 Den won Ju man kon dey argue wit Jon disaipols abaut haw dem sopoz to wosh dia bodi as dia tradishon tok.
26 Som of dem go mit Jon kon tel am, "Oga, di pesin wey dey wit yu for di oda side for Jordan Riva, wey yu tok abaut bifor, en tu, dey baptize pipol and evribodi dey rush go mit am."
27 Jon ansa dem, "Nobodi go fit get enitin unles God wey dey hevun, gi-am."
28 Unasef go fit bear witnes sey, I tok sey I nor bi di Kraist, bot God send mi kom, bifor Kraist go kom.
29 "Di pesin wey won mari new wife naim bi di bridegroom. En frend, wey bi di bestman, dey listin to am. E go dey hapi wel-wel wen e hear di bridegroom dey tok. Na dis dey mak mi hapi and my joy don ful.
30 "Pipol must no Kraist pas as dem no mi.
31 "Di pesin wey kom from hevun beta pas evribodi wey dey for dis wold. And hu dey dis wold, dey tok abaut di tins wey dey insaid di wold.
32 "Bot di pesin wey kom from hevun dey tok abaut wetin e si and hear for hevun, bot pipol nor gri listin to am.
33 "Bot pesin wey biliv wetin e tok abaut God, biliv sey wetin God tok, na tru.
34 "Di pesin wey God send dey tok God wod, bikos God dey giv en Spirit to pipol.
35 "God luv en pikin wel-wel and E gi-am pawa to kontrol evritin.
36 "Pesin wey biliv di onli pikin wey God get, go get life wey nor dey end. Bot pesin wey nor biliv Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey ves wit dat kaind pesin.