Nigerian Pidgin Bible
Joel 3
1 God talk say, na that time I go bring back the prosperity of Judah and Jerusalem.
2 I go gather all nations and bring all these nations come Jehoshaphat valley. Na there I go judge them. Those nations scatter my Israel. They force dem make dem live for other nation, Dem divide my land so I go punish those nations.
3 Dem throw dice to decide who go get the captives. Dem sell boys and girls for slavery and dem use the money pay for prostitute and wine.
4 Wetin una dey try do to me, Tyre, Sidon, and all regions of Philistia? Una dey try pay me back for something? if una wan pay me, I go quickly pay una back .
5 Una don carry my silver and gold and take my treasures into una temples.
6 Una don take my people for Judah and Jerusalem comot for dia own country, sell dem give Greeks. And now I go bring dem comot for where una sell dem. I go do to una wetin una don do to them.
8 I go sell una sons and daughter to people of Judah. Dem go come sell them go far away Serbians. Na wetin God talk be this.
9 Make una make this announcement among nations; Make una ready for war; call una warriors; gather all una soldiers and march.
10 Beat una ploughs to swords, and make spears from una knives. Make weak man talk say, I be strong soldier.
11 Make una hurry come and make una gather for the valley surrounding nations. God, send down your army make dem attack them.
12 Nations wake up make una come Jehoshaphat valley. Na there I go siddon to judge the surrounding nations .
13 Dem dey wicked; make una cut dem down like corn for the harvest time; crush them like una dey crush grapes for full winepress, until the wine dey run over. The barrel go dey full and e go overflow, because them too plenty. 14Thousands and thousands dey for valley of judgement. Na there the day of God go come soon.
15 Darkness go cover the sun and the moon and the stars no go shine again.
16 God go shout from Mount Zion. He go shout from Jerusalem, and the earth and sky go shake. And the Lord God go defend him people. He go be safety place for people of Israel.
17 And una go know say I be una God. I live on top Zion my holy mountain. Jerusalem go become holy. Strangers no go pass through that city again.
18 For that day mountains go drip with sweet wine. The hills go flow with milk, and water go flow through all empty rivers wey dey Judah. Fountain go come from God temple, e go give water to Acacia valley.
19 Egypt go dey empty. Edom go be empty wilderness, because dem dey wicked to the people of Judah. Dem kill innocent people for their country.
20 And people go always dey live for Judah. People go live for Jerusalem through many generations.
21 I go avenge the people wey don die; I no go spare the ones wey dey guilty. And I the LORD go live for Mount Zion!