Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Job 6

1 Job con answer say:

2 I wish say dem fit measure my trouble and worry on top scale,

3 dem go weigh pass sand wey dey sea, so make my crazy word no surprise una.

4 Almighty God don shoot me with him arrow, and the poison spread around my body. God don line up him terror against me.

5 Donkey wey dey chop grass dey okay with wetin him dey chop, and when cow dey chop hay e dey quiet.

6 But who fit chop food wey no get taste or salt? Which kind taste dey for the white part of egg?

7 I no get appetite for that kind food, and everything wey I dey chop dey make me sick.

8 Why God no go give me wetin I ask? Why him no go answer my prayer?

9 Make he just kill me!

10 If I know say him go do am, I for jump for joy, no matter how great my pain go be. I know say God dey holy; I never go against wetin him command.

11 Which kind strength I get to dey live? Why I dey alive when I no get hope?

12 Na stone dem use make me? My body na bronze?

13 I no get any strength to save myself again; nowhere wey I fit turn to for help.

14 For trouble like this, I need friends wey dey loyal - whether I don reject God or not.

15 But una wey be my friend dey deceive me like stream wey dey dry when rain no come.

16 Na snow and ice dey block the stream,

17 But dem dey disappear when heat come, and the streamside go dey dry and empty.

18 Caravan dey lost as e dey look for water; dem dey wander and die for desert.

19 Caravan from Sheba and Tema dey search,

20 But their hope dey die beside stream wey don dry.

21 Una be like those streams to me, una dey see my fate and fear dey make una draw back.

22 Shey I ask una make una give me gift or bribe person for me

23 Or make una save me from some enemy?

24 All right, make una teach me; make una tell me my fault. I go dey quiet and I go listen to una.

25 Honest word dey win person heart, but una dey talk nonsense.

26 Shey una dey try condemn me? Shey una go continue dey talk una words wey dey tire person?

27 Shey una be the kind people wey go gamble for orphans and even plan evil for una owns friends?

28 Look me for face, and see say I no dey lie.

29 Una don go too far. Make una stop to dey do bad-belle. No condemn me. I dey right.

30 But una think say I dey lie - una think say I no know wetin dey right from wrong.

Open Bible reader