Nigerian Pidgin Bible
Job 32
1 Because Job dey sure say him dey innocent, the three men give up to dey try answer him.
2 But person wey dey stand by wey him name na Elihu no fit control him anger again, because Job dey talk say him no do anything wrong and dey blame God. (Elihu na son of Barakel, descendant of Buz, and he dey for the clan of Ram.)
3 He dey vex with Job three friends. Dem no fit find way answer Job and e make am sound like say God dey wrong.
4 Because na Elihu young pass for there, him wait make everybody stop to dey talk.
5 When he see say the three men no fit answer Job, he con vex and he start to dey talk.
6 So, na wetin Elihu talk be this: I dey young, and una old, so I dey fear to talk wetin I think.
7 I tell myself say I suppose una talk, make una wey be old men share una wisdom.
8 But na the spirit of the Almighty God dey come to human being and give them wisdom.
9 No be to dey grow old dey make person wise or help them know wetin dey right.
10 So now I want make una listen to me; make I tell una wetin I think.
11 I calm down dey hear as una dey talk and I wait as una dey find wise word.
12 I pay attention and I hear as una fail; una never deny wetin Job don talk.
13 How una fit claim say una don find wisdom? God must answer Job, because una don fail.
14 Na una Job dey follow talk, no be me, but I no go answer as una do.
15 Job, word don fail them; dem no get answer for you.
16 Make I continue dey wait as dem don keep quiet? Dem no get anything to talk as dem stand for there.
17 No, I go give you my own answer now and I go tell you wetin I think.
18 I no fit wait to talk, I no fit hold the word back.
19 If I no get chance to talk. I go burst like wineskin wey new wine full am.
20 I no fit stand am; I have to talk,
21 I no go side anybody for this matter; I no go please anybody.
22 I no know how to say nice things, and God go punish me fast if I do.