Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Job 19

1 Job con answer them say:

2 Why una just dey suffer me with word?

3 Every time una dey insult me and no dey show shame the way una dey abuse me.

4 Even if I don do anything wrong, how that one take wound una?

5 Una think say una better pass me, and talk of my trouble as proof say I dey guilty.

6 Una no fit see say na God don do this? He don set trap make e catch me.

7 I dey use violence protest against him, but him no dey listen; nobody hear me as I dey cry for justice.

8 God don block way, I no fit enter; he don hide my way for darkness.

9 He don take all my wealth and he don spoil my name.

10 He abuse me for every side. He uproot my hope and leave me to dry and die.

11 God dey vex and he get temper against me; he treat me like him worst enemy.

12 He send him army make dem attack me, dem dig pit and block my tent.

13 God don make my family forget me; I be stranger to those wey know me;

14 my family and my friends don leave me.

15 Those wey be guest for my house don forget me; I be stranger to those wey know me; my servant dey treat me like stranger and foreigner.

16 When I call one servant, he no dey answer- even when I beg am to help me.

17 My wife no like as my mouth dey smell, and my own brother no even wan come near me.

18 Children no like me and dem dey laugh when dem see me.

19 My close friend dey look me with disgust; those wey I love most don turn against me.

20 My skin dey hang on top my bone, I don lean finish; na small time remain for my life.

21 Una be my friend! Make una pity me! Hand of God don strike me down.

22 Why una go suffer me the way God dey do? Una never suffer me reach?

23 How I wish say person fit remember wetin I talk and record them inside book;

24 Or make dem carve my word on top stone with chisel and write them so that e go last forever.

25 But I know say person dey for heaven wey go come defend me at last.

26 Even after disease don chop my skin, as e still dey my body I go see God.

27 I go see am with my own eye, and him no go be stranger. My courage fail because una talk say,

28 How we fit suffer am? Una look for excuse to use attack me.

29 But now, make una fear the sword - the sword wey dey bring God anger on top sin, so that una go know say person dey wey dey judge.

Open Bible reader