Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Job 18

1 Bildad from Shuah con answer say:

2 Job, people like you no fit keep quiet? Try get sense nah; allow us make we say something.

3 Wetin make you think say we dey stupid like sheep?

4 You just dey use vex wound yourself. Shey you go leave earth because you dey vex? Shey God go move mountain make he satisfy you?

5 The light of the wicked go still off; the flame no go burn again.

6 The lamp wey dey their tent go off.

7 Their step been dey strong, but e don weak now - dem go fall to their own advice.

8 Dem waka enter net, and e catch them for leg;

9 a trap catch them for their feet and e hold them.

10 trap dey hide for ground; dem don set trap for their way.

11 Na terror dey wait all around; e dey follow them for every step.

12 Dem been dey rich before, but now hunger dey wire them; disaster dey stand and wait for their side.

13 Terrible disease dey spread over their body and make their hand and leg rotten.

14 Dem don run commot from the tent wey dem dey live safe, and dem go meet death, wey be king of terror.

15 Now anybody fit live for their tent, after dem purify am with sulfur!

16 Their root and branches don die and dry.

17 Na for home and abroad their fame dey end; nobody dey remember them again.

18 Dem go drive them commot from the land of the living, and drive them from light to darkness.

19 Dem no get any descendant, no children.

20 From east go west, everybody wey dey hear wetin happen to them dey shake with fear.

21 Na wetin go happen to evil people be that, those wey no care for God.

Open Bible reader