Nigerian Pidgin Bible
Job 12
1 Job con answer him friends say,
2 Una think say na una be the only wise person wey remain. Una think say when una die, wisdom go die with una.
3 But I get plenty sense as una get; una no smart pass me; una never talk wetin people no know before.
4 Even my friend dey laugh me now; dem dey laugh, although I dey righteous and I no get blame; but e get a time wey God been dey answer my prayer.
5 Una no get trouble, and yet una dey make fun of me; una jam person wey don almost fall already.
6 But thief and godless people dey live in peace, though na their own strength be their only god.
7 Even bird and animal get plenty wey dem fit teach una;
8 make una ask creature wey dey earth and sea for their wisdom.
9 All of them know say na God use him hand make them.
10 Na God dey direct the lives of him creature; everyone life dey for him power.
11 But just the way una tongue dey enjoy dey taste food; una ear enjoy to dey hear word.
12 Old people get wisdom, But God get wisdom and power.
13 Old people get understanding; God get understanding and power to act.
14 When God tear down, who fit rebuild, and who fit free those wey God put for prison?
15 Earth dey dry up when God hold rain; flood dey come when he allow water loose.
16 God dey strong and him dey always win. Person wey dey deceive and person wey dem dey deceive dey for him power.
17 He dey take away wisdom of ruler and make leader dey act like fool.
18 He dey commot king from throne and turn them prisoner;
19 he dey humble priest and men wey dey for power.
20 He dey silent those wey people trust, and take away the wisdom wey old people get.
21 He dey disgrace those wey dey for power and put end to strength of rulers
22 He dey send light to dark place like death,
23 He dey make nation strong and great, but then he dey defeat and destroy them.
24 He dey make their leader foolish and make them waka around inside desert;
25 Dem dey waka around for dark and dem dey stagger like drunkard.